BBC Pidgin of Friday, 26 September 2025
Source: BBC
Justice James Omotosho of di Federal High Court, Abuja, go sit dis Friday on top di emergency application wey lawyers to Nnamdi Kanu bin file sake of im health condition wey dem claim dey go down.
Kanu wey be di leader of di Indigenous People of Biafra (Ipob) dey face seven-count charges of terrorism wey di Nigeria goment sama am since 2015.
E dey currently for di detention facility of di Department of State Services (DSS) since 2021 wen security pipo re-arrest am for Kenya and carry am by force come back Nigeria.
Di initial adjourned date for Kanu matter na October 10, but dem don bring am come front sake of di urgency of di particular issue for ground.
Remember say during di judiciary vacation wey just end on 17 September, Kanu Lawyers bin file application bifor Justice Musa Liman wey dey act as vacation Judge, asking di court to order di DSS to transfer dia client to National Hospital Abuja bicos e dey suffer from life-threatening heart condition.
But Justice Liman no fit hear di application sake of say dem bring am close to di end of di judges vacation, and im as a vacation judge no suppose hear any matter wey di ruling no go dey ready bifor di vacation is over.
Liman, however, promise say im go refer di atter back to Omotosho wey dey handle am bifor, but im go write on top am say di issue dey serious and na mata of life and death, so dat di trial judge no go keep am till di next adjourned date.
Na on Wednesday Nnamdi Kanu lawyers tell BBC News Pidgin say dem don bring dia mata forward from October 10 to September 26 wey be dis Friday.
Wetin dey expected to happen for court
BBC News Pidgin bin don publish tori about di counter-affidavit wey di DSS bin file, telling di court say make dem no grant di application to transfer Kanu to National Hospital.
For insisde dat document wey our tori pesin see, di DSS say dem get one of di best medical facilities for di kontri, and say Kanu dey get enough attention, only say recently, e chose one lead physician wey come change im treatment schedule against di advice of DSS medical experts wey bin dey manage di defendant.
Dem also say di National Hospital na public facility and e no get adequate security measures to keep suspect like Kanu.
For dia own side, Kanu pipo tell di court say comprehensive medical examination show say di Ipob leader dey suffer from issues wey relate to im liver and kidney, and e also get "dangerously low level of potassium".
Emmanuel Kanu, younger broda of Nnamdi Kanu, na im depose to di 11-page affidavit, telling di court say di senior Kanu need to dey for beta hospital wia experts go dey monitor am closely all di time and dey give am adequate treatment.
So e dey expected say di two parties go argue dis mata bifor Justice Omotosho today, but e no dey likely say di trial judge go also rule on di issue today.
BBC News Pidgin dey for di court to bring you details of di tori as e dey unfold.