BBC Pidgin of Monday, 2 June 2025

Source: BBC

Nigerian air force mistakenly bomb vigilantes for Zamfara

Pipo wey dey some villages for Maru Local Goment Area for Zamfara State, northwest Nigeria, don tok say na 20 pipo die as bandits attack dem, and Nigerian army jet wey come fight di bandits drop airstrike wey kill pipo.

Di villagers tok say di bandits carry more dan 50 pipo from di village wey dey work for farm, but di army jet wey come help, mistakenly kill some local vigilante wey dey try fight di bandits.

Pipo for Mani area of Maru Local goment tok say di bandits wey ride come wit motorbike attack dem for afternoon wen dem dey farm.

Dem tok say as di bandits reach, dem begin shoot anyhow and carry some pipo comot.

One pesin wey no wan make dem call im name tell BBC Hausa say dem dey go help di pipo wey bandits attack wen di army jet come, but di jet begin shoot dem and kill some.

Di man tok say, "Di bandits carry 50 pipo but as di army jet see us dey go help, e fly low begin shoot. Eviribodi run for im life and even us wey dey alive na God save us, sake say we lie down for ground."

"We lie down like say dem shoot us too, and wen di jet comot, we stand up run go save ourself."

Anoda pesin wey tok to BBC beg goment make dem help dem well well becos di bandits tok say dem go come back again.

E tok say, "We dey beg goment make dem send more security come protect us. But make di security pipo sabi say sometimes dem dey mistakenly kill our pipo, make dem dey check well befor dem act."

"We tell security afta di attack, but na so di jet just come kill our vigilante pipo."

Up till now, Nigerian army neva tok anytin about wetin happun.

For January 2025, Nigerian army jet mistakenly kill 16 pipo, including vigilante and farmers, for Tungar Kara village for Zamfara State becos dem tink say na bandits.

Still for December 2024, anoda airstrike kill 10 civilians for Sokoto State, and di state govnor tok say na mistake wey affect innocent pipo.