On Sunday, some soldiers storm one TV station for di Republic of Benin wia dem bin declare say dem don overthrow di civilian govment.
But anoda report wey later come out from govment confam say di coup wey di soldiers try do no succeed.
Di soldiers bin criticise how President Talon dey run di govment kontri and how tins bin dey for di kontri at di moment.
So wetin we know about di attempted coup and who stop am?
Nigeria stop di coup for Benin?
According to one statement from Nigeria President spokesperson Bayo Onanuga, Nigeria chook mouth and help stop di coup.
Di statement hail di Nigerian Armed Forces for dia sharp and quick action for di Republic of Benin, wia early morning coup attempt bin wan "scata di country 35-year democracy".
Di statement add say na afta urgent call from Benin govment, President Tinubu order Nigerian Air Force fighter jets make dem secure Benin airspace and flush out di coup plotters wey take over National Television station and regroup for one military camp.
"Today, Nigerian Armed Forces stand strong as defenders and protectors of constitutional order for Republic of Benin after di govment invite dem. Dem help stabilise our neighbour and make us proud of dia commitment to protect democracy since 1999. Nigeria stand firm with di govment and pipo of Republic of Benin."
Dem run di operation under ECOWAS Protocol on Democracy and Good Governance.
Benin Ministry of Foreign Affairs, through one official note, bin beg Nigeria for immediate air support "to protect constitutional order, government institutions and make sure citizens dey safe."
Dem still request surveillance, quick intervention mission and small deployment of Nigerian ground troops under Benin command.
Nigeria Chief of Defence Staff, General Olufemi Oluyede, confirm say dem carry out all di requests. "Our work na to obey di order of our Commander-in-Chief, President Tinubu," e tok.
Who dey behind di coup and wia e dey now?
Reports say di pesin behind di coup na Pascal Tigri wey be Benin military officer (Lieutenant Colonel), e lead di failed coup attempt against President Patrice Talon for 7 December 2025.
E serve as President of di Military Committee for Refoundation, one short-time military junta wey only control some areas and govment offices for Cotonou for few hours.
But afta di failed coup for Benin Republic, nobodi still sabi wia e dey now. Plenty reports dey tok say e dey on di run.
Who be di president of Benin Republic and how long e don dey lead?
Di current president of Benin Republic na Patrice Talon.
E don dey office since April 6, 2016, meaning e don serve about 9 years as of December 2025.
Talon dey expected to step down for April 2026 afta e complete im second term, as e don tok publicly say e no go seek third term.
Wen next election go hapun for Benin?
Di Benin Republic presidential election dey schedule for April 12, 2026.
If no candidate win clear majority for di first round, dem go do second round on May 10, 2026.
Timeline of coups for Benin Republic
Since di 1990 Constitution of Benin and wen di kontri enter democracy for 1991, dem don get several coup attempts for Benin Republic wey no succeed, and di recent one wey some soldiers try no be di first.
Dis na some recent coups for Benin Republic wit dia dates:
.On March 4, 2013, one failed coup attempt hapun for Benin wey Colonel Pamphile Zomahoun lead against di den-President Thomas Boni Yayi. Report tok say Zomahoun try mobilize soldiers to overthrow di govment, but loyal troops quickly stop am. Dem arrest di coup plotters. President Boni Yayi remain for power till e finish im term.
.On September 26, 2024, authorities for Benin arrest three pipo wey dem accuse of planning coup against di govment. Dem no release plenty details about who dem be or dia reason, but di arrest hapun as part of security operation to prevent wahala.
.On December 7, 2025, group of soldiers from Beninese Armed Forces, wey call themselves di Military Committee for Refoundation (CMR) and wey Lieutenant Colonel Pascal Tigri lead, appear for state television and claim say dem don remove President Patrice Talon from office, dissolve national institutions and suspend di constitution. Dem complain about bad security situation for northern Benin, neglect of soldiers wey die and dia families, and alleged favoritism for military promotions. But loyal soldiers quickly take back control, and later President Talon address di nation, e confam say e dey safe and promise say coup plotters go face punishment.
Profile of Benin Republic
Benin Republic na small but culturally rich kontri for West Africa, e dey between Nigeria for east, Togo for west, and Burkina Faso and Niger for north, with Atlantic Ocean for south along di Gulf of Guinea.
Di official capital na Porto-Novo, but Cotonou na di busy city wey serve as economic and administrative hub.
Di kontri get independence from France on August 1, 1960, and today, e dey operate as presidential republic.
French na di official language, but local languages like Fon and Yoruba dey widely spoken.
Economically, Benin dey rely well-well on agriculture, and cotton na di main export, along with palm oil and oda crops.
Di currency na West African CFA franc, and di country dey part of di ECOWAS regional bloc. For religion, Benin diverse, with mixture of Christianity, Islam, and traditional beliefs.
Coups for Africa in recent times
Africa don witness a rise of military coups for recent years, and dis dey unsettle democratic progress across parts of di continent. Di trend become more visible for August 2020, wen Mali experience coup, followed by anoda one for May 2021.
Shortly afta, Chad experience military takeover for April 2021 following di death of President Idriss Déby. Guinea bin join di list for September 2021, wen soldiers remove President Alpha Condé from power.
Di wave spread into di Sahel, wia Burkina Faso bin record two coups for di same year - first for January 2022 wen Lt Col. Paul-Henri Damiba overthrow President Roch Kaboré, den again for September 2022 wen Captain Ibrahim Traoré overthrow Damiba.
For Niger, military junta comot President Mohamed Bazoum for July 2023. Gabon follow for August 2023, wen di military bin end di long-standing Bongo administration shortly after one election wey come with palava.
Sierra Leone bin experience attempted coup for November 2023, and Congo-Brazzaville bin face coup rumours for September 2023, wey authorities deny.
Rumours of coup for Nigeria also spread for October 2025 but authorities deny am.
Most recently na di coup wey take place for Guinea-Bissau, wia di military comot Umaro Sissoco Embaló a day bifor di electoral commission suppose announce results of di kontri presidential election.
Di Guinea-Bissau military bin suspend di electoral process and block di release of di results, as dem insist say dem prevent plot to destabilise di politically unstable kontri.
Dis rising pattern show deeper issues wey concern insecurity, governance failures, economic hardship, and public distrust for political institutions.











