You are here: HomeAfricaBBC2024 04 09Article 1925264

BBC Pidgin of Tuesday, 9 April 2024

Source: BBC

Nigeria recova N30bn during poverty minister probe

Di 37-year-old poverty alleviation minister bin deny any wrongdoing wen dem suspend her for January Di 37-year-old poverty alleviation minister bin deny any wrongdoing wen dem suspend her for January

Nigeria don recova 30bn naira ($24m; £19m) from one suspended minister as part of one ongoing corruption investigation, Financial watchdog tok.

Dem trace di moni go more dan 50 bank accounts.

Nigeria goment bin suspend di Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation Minister Betta Edu for January say she allegedly divert $640,000 public moni into personal bank account.

President Bola Tinubu come order investigation into her ministry.

At di time, Dr Edu wey be 37-year-old bin deny any wrongdoing. Her office tok say she bin approve di transfer into personal account, wey no dey in her name, but say na for di "implementation of grants to vulnerable groups".

Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) tok say during dia nearly six weeks of investigation, so far dem discova "many angles" to torchlight.

"As e dey now, we dey investigate ova 50 bank accounts wey we trace di moni enta. Dis no be child play. Na big deal," dia chairman Ola Olukoyede tok for di latest edition of di agency monthly e-magazine, EFCC Alert.

E encourage Nigerians wey dey find justice to give di agency time to finish dia investigation thoroughly.

"We dey explore so many discoveries wey we don see for our investigation. If na to see say pipo dey for jail, make dem no worry, evritin get process to follow," e tok.

Di EFCC chairmo give assurance say di funds dem recova don "already dey di purse of di federal goment".

Di suspension of a minister no too common for Nigeria.


Why Tinubu suspend Betta Edu?

Betta Edu become di first minister under President Bola Tinubu to come under public condemnation for crime wey authorities and court neva confam say she commit.

Reports allege say she give instruction for di payment of one big moni - ova 585 million naira to one private account.

But di Accountant General of di federation for statement bin come out to say, dem no pay di said moni into di personal account as Betta bin instruct dem for her letter.

Dr Betta Edu na one of di women wey President Bola Tinubu inaugurate as part of im Executive Committee.

Wen dem swear am in about six months ago, her appointment as minister receive commendations as she be one of di youngest for di president cabinet.

Her portfolio also dey veri sensitive sake of say she go dey work wit youth, men and women, and dose wey need urgnt help wey natural or man-made disaster cause.