BBC Pidgin of Tuesday, 7 October 2025
Source: BBC
Nigeria Minister for Innovation, Science and Technology, Uche Nnaji don deny di accuse say e forge im degree and National Youth Service Corps (NYSC) certificates, but say na politicians for im state dey blackmail am.
Oga Nnaji don dey for di eye of di storm since tori pipo Premium Times publish one investigation wey dem do wey allege say di Minister no graduate from di University of Nigeria Nsukka (UNN) as e dey claim.
Di online newspaper also allege say di minister dey parade NYSC certificate wey be fake.
Premium Times say dem bin write Freedom of Information (FOI) letter to di Vice Chancellor of UNN, Simon U. Ortuanya, about oga Nnaji, and di VC reply dem say true-true, di Minister bin get admission for di University for 1981, but dem no get any record wey show say e graduate.
However, for one press conference wey di Minister office call dis Monday for Abuja, im tok-tok pesin Robert Ngwu tell tori pipo say di report by Premium Times na lies.
"Chief Uche Nnaji na proud alumnus of UNN, as e graduate for July 1985 wit a B.Sc. Degree for Microbiology/Biochemistry, wit second class (honours) lower division," Ngwu tok.
E also refer tori pipo to one letter by one former registrar of UNN on December 21, 2023, wey confam say Uche Nnaji bin graduate for di school.
"Two years later, in May 2025, one purported letter bin surface - wey di university allegedly write - wey suddenly claim say dem no get records of di Minister graduation. Di question wey evri Nigerian suppose ask na: Wetin change between December 2023 and May 2025?" Ngwu tok.
Di minister tok-tok pesin also say di Minister bin carry di mata go court wia di court bin give order to UNN, on 25 September dis year, for dem to release im academic transcript, among oda tins. But until today, di university neva release di transcripts.
During di press conference, BBC News Pidgin tori pesin ask di minister tok-tok pesin, wetin dem get to tok about di allegation of NYSC corticate forgery wey Premium Times claim, and e say dat one na "non-issue", bicos Premium Times for dia so-called investigation bin no publish any letter by NYSC wey tok say di Minister bin no do im National Service.
"Di Minister serve im kontri wella for Plateau State and dat one no dey in contention," Ngwu tok.
Although, for di PT investigation, dem show some differences wey dey for di NYSC certificate wey di Minister bin present give di Senate during im screening, wen you place am side by side wit oda NYSC certificates wey dem issue for di same 1986 wey di Minister claim say im serve.
