You are here: HomeAfricaBBC2023 08 11Article 1823267

BBC Pidgin of Friday, 11 August 2023

Source: BBC

Niger coup update: Wetin be di Standby Force wey Ecowas dey send go Niger?

ECOWAS leaders in a group photo after a summit in Abuja ECOWAS leaders in a group photo after a summit in Abuja

No be tori again say di Economic Community of West African States (Ecowas) don agree to organise a "standby military force" on top di coup mata for Niger.

Dis na as West African leaders bin approve di use of armed intervention for Niger "as soon as possible" afta meeting to tok about di coup.

As at now too much information neva dey on top wetin dis standby force go be and who go dey inside.

  • Ecowas order deployment of standby force to restore constitutional order for Niger


  • Niger coup: 'We gatz prioritise negotiations and dialogue' - Tinubu tok as Ecowas hold summit


  • Howeva from di extraordinary summit of Ecowas members on Thursday, Ivory Coast President Alassane Ouattara don reveal say im kontri dey ready to deploy around 850 and 1,100 troops fo Niger as part of di regional intervention.

    Also France and di US don reveal say dem support di Ecowas resolution on top dis Niger coup mata.

    Meanwhile di Nigerian President of di Senate Godswill Akpabio bin tok afta di meeting say dia agreement na to advise president Tinubu to use tok-tok address di incident wey dey happun for Niger.

    "Di Senate commend President Ahmed Bola Tinubu and oda Heads of States and goments Ecowas for dia prompt response and di position dem take on di unfortunate development for Niger Republic," oga Akpabio tok.

    Di lawmakers agree say make dia leaders meet wit di president as chairman of Ecowas to further "encourage oda leaders of Ecowas to strengthen di political and diplomatic options" and make dem find oda means to resolve di political wahala for Niger Republic.

    Wetin be di Ecowas Standby Force (ESF)?

    Di ESF na multidisciplinary force, dis mean say e dey come from different parts of di armed forces. Na multidisciplinary force wey dey made of di military, police and civilian staff from di Ecowas Member kontris dem.

    Dia work na to provide pipo wey go participate for regional and continental peace support operations as well as intervention missions.

    Dis dey come as Burkina Faso and Mali, both wey currently dey under miltary rule don hala say dem go take any military intervention as sign of war.

    Di ESF na part of di Ecowas Conflict Prevention Framework (ECPF) of di regional bloc.

    Im objective according to dis framework na to guarantee peace and security for mata of kasala and disaster wit di use of effective observation and monitoring, preventive deployment and humanitarian intervention.

    Dia charter also include to train and equip multi-purpose complex units wey go get military and civilian parts from Member States and di way dem go run am na according to di arrangement of di African Standby Force.

    Sabi pipo don tok say dis assembly of personnel fit take weeks to organise so e still leave room of pipo dem to tok with each oda.