You are here: HomeAfricaBBC2023 08 10Article 1822433

BBC Pidgin of Thursday, 10 August 2023

Source: BBC

Niger coup: Sanusi Lamido Sanusi visit General Tchiani and President Bola Tinubu led Ecowas meeting today

Di ECOWAS leaders Di ECOWAS leaders

Nigeria's President and Chairman of di West Africa regional bloc, ECOWAS don tok say dem gatz give priority to diplomatic negotiations and dialogue in resolving di political crisis for Niger wia a military coup bin comot President Mohamed Bazoum from power about two weeks ago.

President Tinubu tok dis for di opening session of di ECOWAS Heads of State extraordinary summit on Niger, Thursday for Abuja, Nigeria's capital.

E also note di roadblocks wey di previous envoys wey dem send go mediate wit di military Junta for Niger bin encounter.

"We gatz engage all parties involved, including di coup leaders, in earnest discussions to convince dem to relinquish power and reinstate President Bazoum. Na our duty to exhaust all avenues of engagement to ensure a swift return to constitutional governance for Niger." President Tinubu add.

Di ECOWAS Chair also note say di political crisis for Niger also pose a threat to di stability of di West African region.

Oga Tinubu express confidence say dis second summit on resolving Niger's crisis go be "defining moment" towards a "stronger, more resilient, and integrated West Africa".

Heads of State from di regional bloc wey include neighbouring Mauritania and dia East African counterpart, Burundi dey in attendance.

Ecowas military action fit happun?

Di tin be say easy options no dey for di for West African leaders.

Dem dey anxious to restore democracy for Niger - a vast nation wey get plenty poor pipo wey dey also already battle against Islamist insurgents.

But di soldiers wey seize power for Niger don so far, ignore diplomatic and economic pressure.

Di regional bloc, Ecowas wey Nigeria dey lead don also threaten military force.

A few years ago, dat one fit just be di fairly straightforward option.

But oda neighbouring kontris - Mali, in particular - don recently bow to military coups, wit support by Russian mercenaries. And dem don begin side wit di generals for Niger.

Plenty tins dey at stake now - for a massive and increasingly unstable interest for Africa.

Ecowas bin give di military pipo seven-day ultimatum to return Niger to civilian goment.

Dem even threaten military action if di coup plotters fail to return President Bazoum.

But di seven-day ultimatum don pass and Ecowas heads of goment go meet on Thursday for Nigerian capital, Abuja, to discuss dia next move.

Many pipo wey dey stay for di region dey fear of wetin fit happun next sake of say di deadline wey Ecowas give di coup pipo don pass.

Sanusi Lamido meet Tchiani

Former govnor of Nigeria Central Bank, Lamido Sanusi land for Niger to meet wit di junta leaders.

Di former Emir of Kano meet wit di leader of di coup, General Abdourahamane Tchiani on Wednesday.

"Interventions dey go on and we go kontinu to do our best to bring di two parties togeda to improve understanding," di ogbonge traditional ruler tok

E no clear who send Oga Sanusi go Niger - Ecowas or di Nigerian goment neva tok about di visit wey happun on di eve of di meeting wey di regional bloc dey hold for Abuja.

Sanusi Lamido Sanusi na di spiritual leader (Khalifah) of di Tijaniyah Islamic movement for Nigeria, a movement wey get millions of members across West Africa, including Niger.

Junta leader name transitional cabinet

In di meantime di military junta don appoint ministers into im cabinet.

Di head of Niger junta, di National Council for di Safeguarding of di Homeland (CNSP), Brig Gen Abdourahmane Tchiani appoint im cabinet to oppose calls by regional leaders wey dey ask am to restore ousted President Mohamed Bazoum.

E announce di cabinet for state TV for 00:30 GMT (01:30 local time) early mor-mor on Thursday.

Inside di new goment na 21 ministers, including two ministers of state and one delegate minister.

Di new transitional goment, na military and civilian personalities, di leader na interim Prime Minister Lamine Zeine Ali Mahamane, wey go also double up as di minister of economy and finance.

Former chief of staff Lt Gen Salifou Mody, wey many dey reason say go be Tchaini deputy, don dey named minister of national defence.

Col Maj Abdourahamane Amadou, wey be don dey read di majority of CNSP communiques for state TV since di 26 July coup, na minister of youth and sports.

Di junta already name new military chiefs and sack most of di senior goment officials wey bin serve for Bazoum administration.