Nicole Kidman and Keith Urban don separate after nearly 20 years togeda, one source tell BBC.
Di A-List couple get two children, Sunday Rose, 17, and Faith Margaret, 14.
Di Oscar-winning actress and four-time Grammy winning country singer don dey married since June 2006.
TMZ first report di news and cited sources wey say di two bin dey live separately since summer and Kidman no want di separation. BBC source confam dat report.
Di reason why dem separate no clear.
Kidman and Urban, wey both grow up for Australia, don go through ups and downs for dia nearly twenty years togeda.
Dem experience highs with both stars wey win and dey nominated for top honours for dia respective industries. Over di years, dem don support and encourage one anoda, dem dey show togeda for award shows and Hollywood premiers.
And di lows: months after dia wedding, Urban checked imself enter rehab for drug and alcohol addiction. Both im and Kidman don tok say im struggles with addiction make dia bond stronger.
Kidman and several of im close friends stage intervention wey Urban say change im life.
"Everytin just dey designed, I believe, for dat moment to join us togeda," e tok for one 2010 appearance for The Oprah Winfrey Show.
"I look back now and realize say Nic don teach me so much and bring so much into my life and open my eyes in so many ways," e tok. "[Dis na] di best place I don ever dey."
Dem sight di two togeda for summer for June as dem dey watch one FIFA Club World Cup match for Nashville, Tennessee.
Dem also appear togeda for May wen dem honour Urban for di Academy of Country Music Awards wit di ACM Triple Crown Award. Dem snap dem picture for dia seats as dem appear happily in love, kissing and holding hands.
The Babygirl actress bin dey married to actor Tom Cruise before. Di two bin dey togeda for more dan 10 years and also get two children togeda. Dem end dia marriage for 2001.











