Di list of di women wey be di most powerful for di world don comot and many of dem na pipo wey don make impact for di year 2023, according to Forbes.
Dis women na from different kontris of di world and dia impact bin cut across various aspect of di society wey dey get effect on di pipo and dia livelihood.
Women don begin dey occupy different positions for di world and dis don ginger odas to take di center stage to do tins wey go impact di world.
Dis year list of di most powerful women for di world bin contain 100 strong women wey include financial experts, politicians, philanthropists, business women, and technologists.
One of di popular person wey make di list na di popular female pop-star Rihanna wey sit for number 74 of di list.
Di 35-year-old music star dey very well-known for her style of singing ‘Umbrella’, one of her very popular song for 2007.
For dis year 2023, di movie ‘Barbie’ bin make big wave all ova di world. Di official music video alone get millions of views for Youtube wen e bin come out and di number dey increase since dat time. Di Barbie movie don make about $537.4 million for di US box office wit different premiere venues for different kontris.
Na dat influence even make Barbie enta di list of most powerful women for di world for number 100.
Taylor Swift and Beyoncé bin spark billions of dollars for consumer spending sake of say dia influence on consumers dey so powerful wey di Federal Reserve chairmo Jerome Powell even address am for July.
Beyoncé jump reach No. 36, up from 80 wey she be for 2022.
How dem determine di 100 powerful women 2023
Di 2023 list dey determined by four main factors wey be money, media, impact and spheres of influence wey di women dem get.
For di ones wey be political leaders, dem weigh dia gross domestic products and populations.
For everyone of di women wey make di list, dem analyse dia media mentions and social reach.
According to Forbes, diz na di 100 women wey dey shape di policies, products and political fights wey define our world.
Name Age Kontri Category
1 Ursula von der Leyen 65 Belgium Politics & Policy