You are here: HomeAfricaBBC2024 05 14Article 1930744

BBC Pidgin of Tuesday, 14 May 2024

Source: BBC

New Chat-GPT go teach maths and dey flirt - but issues still dey

Logo of ChatGPT Logo of ChatGPT

OpenAI don unveil di latest version of di tech wey support dia AI chatbot ChatGPT.

Dem call am GPT-4o, and e go dey rolled out to all users of ChatGPT, including non-subscribers.

E dey faster pass di earlier models and dem don programme am to sound like talkative and make e sometimes dey flirtatious wen e dey respond to questions.

Di new version fit read and discuss images, translate languages, and identify emotions from visual expressions. E also get memory, so e fit remember previous prompts.

You fit interrupt am and e get easier conversational rhythm – no delay between di time pesin take ask question and wen e go receive answer.

Di new version of Chat-GPT dey trained on plenty amount of mathematical data, wey go allow am provide explanations for various math problems.

Apart from im educational capabilities, di new version of Chat-GPT also include flirting feature. E showcase di versatility of AI technology and dia ability to imitate human conversation in various contexts.

Glitches

During one live demo wey dem use di voice version of GPT-4o, e provide helpful suggestions on how pesin fit solve simple equation dem write on piece of paper.

E analyse some computer code, e translate between Italian and English and interpret di emotions inside selfie of pesin wey dey smile.

Using a warm American female voice, di latest version go greet dia users and ask dem how dey dey. Wen you pay compliment, e go respond: “Stop it, you dey make me blush!”.

E neva dey perfect – at one point e mistake a smiling man for wooden surface, and e begin solve equation wey dem neva show am. Dis show say small work still dey for dem to do to make am perfect.

But e dey show us di direction of travel for OpenAI, wey mean say GPT-4o go become di next generation of AI digital assistant, a kind of turbo-charged Siri or Hey, Google wey dey remember wetin dem tell am for di past and wey fit interact beyond voice or text.

Clarifications

We don see chatbots like Elon Musk Grok and Pi, from DeepMind co-founder Mustafa Suleyman, prioritise di “personality” of dia products, but di way wey GPT-4o effortlessly handle di combination of text, audio and images wit instant response appear to put OpenAI ahead of di competition.

OpenAI chief technology officer Mira Murati describe GPT-4o as “magical” but add say di firm go “remove dat mystery” wit di product roll-out.

Rumours dey about partnership between OpenAI and Apple and while dis no dey confirmed, e show during di presentation as dem use Apple products throughout.

Anoda tin na di timing of dis event, 24 hours before dia rival Google dey due to show off dia latest AI developments for dia annual conference, Google IO.