Two famous Nigerian women, Ngozi Okonjo-Iweala and Mo Abudu again make dI list of Forbes' 100 World's Most Powerful Women for 2025.
Di World Trade Organization (WTO) Director and di CEO EbonyLife Mo Abudu feature alongside world figures like European Commission President Ursula von der Leyen wey be number one on di list, European Central Bank President Christine Lagarde, Japan first female prime minister, Sanae Takaichi and Namibia President Ndemupelila Nandi-Ndaitwah.
Di magazine wey publish di list on dia website on Wednesday, 10 December recognise women wey hold ogbonge influence in business, politics, culture, and global leadership.
For dia 22nd annual ranking of The World's 100 Most Powerful Women, Forbes highlight di most dynamic female leaders, innovators, and changemakers wey shape di global landscape in 2025.
Na four main metrics wey include money, media, impact and spheres of influence Forbes take determine dis year ranking. Dem also consider six sectors wey include business, technology, finance, media & entertainment, politics & policy, and philanthropy.
Di listees collectively dey oversee more dan $4.9 trillion in revenue, employ ova 9.3 million pipo, and influence countries wey represent more dan half of global GDP.
Forbes say dia 2025 Forbes Power Women list na women wey tanda as examples of resilience in turbulent times.
"As global power structures rapidly shift, dis year listees dey steer platforms, policies and capital wey dey redefine di world most important industries and economies," Moira Forbes, Executive Vice President tok.











