BBC Pidgin of Friday, 29 August 2025

Source: BBC

More revelation unfold about 23-year-old wey dey behind Minneapolis school shooting as FBI say na anti-Catholic hate crime

Minnesotans no go step away' afta shooting, according to Governor Tim Walz Minnesotans no go step away' afta shooting, according to Governor Tim Walz

Shooting for one school for Minneapolis don lead to di death of two children while 17 odas bin wunjure, and more revelation about di shooter don come out.

Investigation don begin ontop di shootin as di Federal Bureau of Investigation (FBI) say na anti-Catholic hate crime.

Di attacker open fire on di two children wey dia age na eight and 10, through di windows of di city Annunciation Church on Wednesday morning as children bin dey celebrate Mass.

"Di FBI dey investigate dis shooting as act of domestic terrorism and hate crime targeting Catholics," FBI Director Kash Patel tok for im post for X.

Di attack bin happun just bifor 08:00 local time (13:00 GMT) on Wednesday for Annunciation Church, wia children bin dey attend worship service during dia first week of school.

Pope Leo XIV, wey be di first American pope dey among dose wey pay tribute to di young victims, say e dey "profoundly saddened" by di attack.

Police Chief Brian O'Hara tell reporters say "dis na deliberate act of violence against innocent children and oda pipo wey dey worship."

"Di bad mind and cowardice to fire into di church wey dey full of children dey absolutely incomprehensible," e say.

Di Minneapolis Police Department dey lead di investigation wit support from federal agencies - and go pursue evidence wia eva e lead.

Who be di Minneapolis shooting attacker

Di attacker die for di scene as e inflinct gunshot on imsef. Di police later name am as 23-year-old Robin Westman, from suburban Minneapolis.

Dem neva sabi Westman motive.

Di attacker bin dress for all black as e approach di side of di church, wey dey also house school, and fire dozens of shots through di windows using three firearms.

E use rifle, shotgun, pistol and di police also find smoke bomb for di scene.

Officials dey investigate if di suspect shoot inside di building or if all di shoots come from outside di church, as dem no find any no casings from bullets inside.

Minneapolis Police Chief Brian O'Hara say di attacker no get "extensive known criminal history", and e act alone.

Police bin find "manifesto" wey di suspect bin timed to publish for YouTube for di time of di shooting, but di FBI assist officials to take am down.

Di attacker mother, Mary Grace Westman, previously work for di school, according to school newsletter from 2016.

One post for Facebook say di attacker mother bin retire from di role for 2021.

"Our hearts dey broken for di families wey don lose dia children and fi young lives wey dey fight to recova and for di entire community wey dey deeply traumatised by dis senseless attack, police say.

Eyewitness tok how di Minneapolis shooting happun

Police begin dey receive calls of di shooting just bifor 08:00 local time (13:00GMT) on Wednesday.

"I hear 'boom, boom, boom'," PJ Mudd, wey dey live close to di church and dey work from home on Wednesday morning, tell di Wall Street Journal.

"E suddenly shock me say na shooting."

E run go di church wia e see three magazine cartridges for di ground.

10-year-old boy wey survive di attack tell CBS affiliate WCCO say im friend saved am from bullets by lying on top of am.

"I dey like two seats away from di stained glass window," e say. "My friend, Victor, save me though, becos e lie ontop me, but di bullet hit am."

"My friend got hit for di back, e go di hospital... I dey super scared for am but I tink now say e dey okay," e say.

Di Annunciation Church dey located for residential area of southern Minneapolis, wia dem dey teach students between age five and 14.

Wetin be di Annunciation School?

Annunciation Catholic Church and na faith-based school for students from preschool (nursery-level) up to Grade 8 (aged 14 years old), according to dia website.

E dey located for residential area of southern Minneapolis.

Di Catholic school approach to teaching na one of faith-based learning.

Di school add say religion "compels" am to engage wit dia local community. E also get sister school for Haiti.

Principal Matt DeBoer speak for press conference on Wednesday and begin im remarks by saying "I love you, I dey so sorry dis happun today".

E thanked well-wishers for dia thoughts and prayers and ask pipo to "pray wit our feet" to take action against future shootings.