You are here: HomeAfricaBBC2024 04 18Article 1926692

BBC Pidgin of Thursday, 18 April 2024

Source: BBC

Mohbad wife reply tori say court wan order for DNA test

For different court sitting, dem expect say di autopsy result go come but e neva show. For different court sitting, dem expect say di autopsy result go come but e neva show.

As di gbege ontop di death of Ilerioluwa Oladimeji Aloba aka Mohbad still dey kontinu, di wife tok say she neva receive any court notice wey order her to come for DNA test.

Dis reply come from di lawyer wey dey represent Wunmi Aloba, Mohbad wife as im confam say nobody don serve any court order to her.

Dis gbege dey happun afta tori comot say di court don tok say make dem serve Wunmi a notice for DNA test.

Lawyer to Wunmi tell BBC News Pidgin say as nobody don serve dem any court notice, no how wey dem go take comment ontop di matter.

“You get di copy of di court order? We no get am, if to say we get di court order we go fit comment ontop am.” Taiwo Olawanle tok.

Rememba say for 12 September 2023, di management of popular musician Mohbad confam di death of di ogbonge artiste.

Serious gbege bin start as many pipo start to dey request say make dem do autopsy ontop di body.

Afta dem comot di deadi body of Mohbad comot from di grave wey dem keep am, dem still neva release di result of di autopsy.

Di DNA palava

Anoda serious gbege wey happun na how di papa of Mohbad dey ask say make dem do DNA test for di pikin wey late Mohbad leave behind.

For one interview wit di BBC News Pidgin Oga Joseph Aloba (Mohbad papa) tok say im want make dem do di DNA for im grandson.

Di papa and im legal team begin file say make Wunmi carry di pikin come for DNA.

But contrary to di tori say di court don request make Wunmi appear for di DNA test, di lawyer Taiwo Olawanle wey dey represent Wunmi for court tok say dem neva serve her any notice.

“Nobody don serve her any court order or notice and I fit confam dat one to you,” di lawyer tell BBC Pidgin

Wen Mohbad autopsy result go comot

Since wen di body of Mohbad don dey mortuary for autopsy, plenti pipo don dey expect wen dem go bring di result to know wetin kill di young musician.

For different court sitting, dem expect say di autopsy result go come but e neva show.

However, di Director wey dey incharge of di Lagos State DNA and Forensic Centre, Dr Richard Somiari tok say di autopsy result go soon ready.

Im tok dis one afta di court bin get dia sitting for March 2024 wia im tok say di result go ready in ‘three to four weeks’.

According to report by local media ChannelsTV, one magistrate Court wey dey sit for Ikorodu Lagos bin order say make dem serve di wife of Mohbad wit a notice ontop di DNA matter.

Dis na afta di Aloba family go court say make dem go do DNA for one laboratory wey dem recognise for Lagos.

Dem report say attempt to serve Wunmi wit di notice dey fail, but her family tok say dem neva see any court order.

'Mohbad struggle till death' - Singer wife

Di wife of Ilerioluwa Oladimeji Aloba aka Mohbad bin reveal during di coroner inquest say di artiste bin dey go through a lot before im death.

Di singer wife identified as Wunmi tok dis one for Instagram live as she dey mourn di death of her husband.

She tok say Mohbad bin struggle till death as di artiste get too much pains and threat.

Wunmi tok say her husband bin dey live in fear and e dey engage in fights evri where im go.

According to Wunmi, her husband neva dey happi for a whole day.

Wetin happun so far

Di Nigeria Police Force bin assure family, friends and fans of di late Nigerian singer Mohbad say dem go investigate di circumstances wey surround di death of di 27-year-old artiste.

Di management of Mohbad confam di death of di singer afta tori of im passing begin spread.

Di wife bin reveal reason why her husband no ever go hospital wen im get injury for hand.

Dis na sake of how many pipo dey question why she no quickly carry am go hospital.

Wunmi Aloba appear for court for di coroner inquest sitting wey dey look into di cause of death of her husband.

She tell di inquest say e get reason why her husband hate to dey go hospital afta im don face many threat issues from im former label.

Wunmi tok say di whole fear begin from wen Mohbad make attempt to comot di record label and di time wen officers of di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) bin carry am and oda record signees.

Na different witnesses don dey testify for court since di siting bin begin and e neva end.

Na Spending bin appear as witness last wia im tok how di fight of Mohbad and Primeboy bin happun bifor di death.