You are here: HomeAfricaBBC2023 10 25Article 1868873

BBC Pidgin of Wednesday, 25 October 2023

Source: BBC

Mohbad papa, wife, mama show to testify for coroner inquest wey dey chook eye for im death

Mohbad Mohbad

Di coroner inquest wey dey siddon for Ikorodu don invite witnesses for evidence to di cause of death of late musician Ilerioluwa Oladimeji Aloba wey dey known as Mohbad.

Di coroner inquest dey look into di cause of death of di late musician. Di musician death draw a lot of attention and demand for justice for am.

Some of di witnesses wey appear for court na di father of di late musician Mr Joseph Aloba, Wunmi (wife of Mohbad), DJ as well as mother of di deceased.

Mohbad papa testify for court everything wey im know about im pikin till wen e die.

Di papa tender a written witness address and di court adopt am as e begin dey answer questions.

Different lawyers go examine di witnesses wit different questions wey go lead dem to how di late musician die.

Akin George wey represent di Ministry of Justice ask different questions wey go helep di court wit dia findings.

Our eye still dey dis tori, continue to dey refresh to get di latest.