Michelle Obama don tok out against rumours say her marriage to Barack Obama fit dey in trouble.
Di former first lady no follow her husband go plenty big events – including Donald Trump inauguration and di funeral of former President Jimmy Carter – wey dey put fire for rumours say dem fit don separate.
Witout to tok about dis times, Mrs Obama tell di Work in Progress podcast wey actress Sophia Bush host say she don dey in position to control her own calendar as a "grown woman".
She tok say pipo no fit believe say she dey "make decision" for hersef and instead dem "dey assume say my husband and me dey divorce".
Mrs Obama tok say she bin dey feel small guilt for stepping back from some duties.
"Na one of di tins wey we as women dey always struggle wit di fear say we go disappoint people," she tok.
"I mean, e even reach di point this year wey pipo no fit believe say I dey make choice for myself dem just dey assume say me and my husband dey divorce.
"Dem no believe say na just grown woman wey dey make decision for hersef, abi? But na wetin society dey do us."
Mrs Obama still tok for di podcast say: "I choose to do wetin good for me. No be wetin I must do. No be wetin I tink say oda people wan make I do."
Even though she no show face for President Trump inauguration wey many pipo see as breaking tradition she still give one big speech for Democratic National Convention (DNC) dis past summer.
"Hope dey come back," na wetin she tell thousands of pipo wey gather for Chicago during di DNC, as she ask make dem support Kamala Harris wey be presidential nominee dat time.
Even though she don create more time for hersef, di former first lady still tok say she still dey find time to "give speeches, show face for outside, and work on different projects. I still care about girls' education."
Di Obamas celebrate dia 32nd wedding anniversary last year October.
Mrs Obama don tok openly befor about di wahala wey she face for her marriage becos of Mr Obama political ambition and di time wey dem spend for White House for her best-selling memoir, Becoming.
For di book, she tok say her husband dream and career cause her plenty loneliness and tiredness.











