BBC Pidgin of Wednesday, 3 May 2023
Source: BBC
Lionel Messi decision to travel to Saudi Arabi without di permission of Paris St-Germain fit don end im career wit di club.
Dis na wetin BBC Sport journalist Simon Stone tok.
PSG bin suspend di Argentina captain on Monday for two weeks afta im travel go di middle east kontri.
Messi bin travel afta di French club home defeat to Lorient on Sunday, for match wey im play full 90 minutes.
Messi no go train or play for PSG during di period of im suspension.
Tori be say di 35-year-old bin ask for permission to travel to carry out commercial work but dem no gree am.
Messi, also chop fine from di club sake of dis waka, di Argentina captain na tourism ambassador for Saudi Arabia.
And na dis summer di World Cup winner two-year contract wit PSG go expire.
Barcelona Vice-President Rafael Yuste bin claim for March say di Spanish club dey do tok-tok wit Messi about im return to di Nou Camp.
Messi don score 31 goals and contribute 34 assists for 71 games in all competitions for PSG, and win di Ligue 1 title last season.
Im dey set to miss matches against Troyes and Ajaccio as PSG, wey dey five points clear wit five games to go, dey look to win a ninth league title in 11 seasons.