You are here: HomeAfricaBBC2023 09 17Article 1845872

BBC Pidgin of Sunday, 17 September 2023

Source: BBC

Meet Jamila and Ayodele - Tinubu nominees as ministers of Youth

Shugaban Najeriya Bola Ahmed Tinubu Shugaban Najeriya Bola Ahmed Tinubu

President Bola Tinubu don appoint two young pipo as ministers of youths. Di appointment come afta di president remove over 60 year old Abubakar Momoh as youth minister.

For im latest appointments president Tinubu nominate Jamila Bio Ibrahim and Ayodele Olawande as di pipo to lead Nigerian youths under im administration.

“President Bola Ahmed Tinubu don approve di nomination of Dr Jamila Bio Ibrahim to serve as di Minister of Youth, pending her confirmation by di Senate of di Federal Republic of Nigeria,” Na so Ajuri Ngelale tok for statement wey e release on Sunday.