You are here: HomeAfricaBBC2023 09 04Article 1837781

BBC Pidgin of Monday, 4 September 2023

Source: BBC

Meet Ghandi Olaoye di RCCG pastor wey emerge as di Soun of Ogbomoso

Di Oyo state govnor Seyi Makinde Di Oyo state govnor Seyi Makinde

Afolabi Ghandi Olaoye don emerge as di Soun of Ogbomoso, one ogbonge traditional position for Oyo state, South west Nigeria.

Di state govnor Seyi Makinde give di approval for Ibadan, Oyo State capital.

Tori bin don dey spread say na since Wednesday di govnor choose di crowned prince of Ogbomoso as di Soun.

Olusegun Olayiwola, di Commissioner for local goment and Intelligence Affairs make di announcement for statement e release on Saturday.

Olayiwola say di announcement come afta long selection process wey law mandate di state to follow - “His Excellency congratulate di new Soun-elect on im ascension to di throne of im forebears,” e tok.

We dey update dis tori