You are here: HomeAfricaBBC2023 12 31Article 1905857

BBC Pidgin of Sunday, 31 December 2023

Source: BBC

Meet Françoise Bettencourt Meyers, di first woman to gada $100bn fortune

L'Oréal heiress Françoise Bettencourt Meyers L'Oréal heiress Françoise Bettencourt Meyers

L'Oréal heiress Françoise Bettencourt Meyers don become di first woman to gada $100bn (£78.5bn; €90.1bn) fortune, according to one ranking of di richest pipo for di world.

Di French beauty empire wey her grandfather start dey on record for dia best stock market performance in decades.

L'Oréal shares bin rise to a record high for Paris on Thursday.

Di firm don see dia sales bounce back afta di pandemic, wen pipo under lockdown bin dey use less makeup.

Di net worth of Ms Bettencourt Meyers, wey be 70-year-old, cross $100bn on di Bloomberg Billionaires Index, wey make her di 12th richest pesin for di world.

She still dey distance away from her French counterpart Bernard Arnault, wey dey second on di list wit a net worth of $179bn.

Oga Arnault na di founder of LVMH, di world biggest luxury group, wey get portfolio of high-end brands including Fendi and Louis Vuitton.

L'Oréal no immediately respond to BBC request for comment.

Who be Françoise Bettencourt Meyer?

Ms Bettencourt Meyers na di vice-chairperson of di company board. She and her family na di single biggest shareholders of L'Oréal wit a stake of around 35%.

She become di reigning heiress of L'Oréal afta her mother, Liliane Bettencourt, die for 2017.

Liliane, wey dem regularly dey name as France richest pesin, bin maintain close ties wit French leaders and she embrace di media limelight.

During her later years, she enta one public fight wit Françoise, her only child, she bin accuse one photographer and socialite say e take advantage of her mother mental frailty.

"My daughter suppose wait patiently for my death instead of doing all she fit do to fast-track am," she tok for one TV interview.

For 2011, one French court bin rule say Liliane get one form of dementia, and dem award Françoise control ova her wealth and income.

Di court bin task anoda family member to look afta Liliane health and physical well-being.

Bettencourt Meyers also serve as di president of her family philanthropic foundation, wey de encourage French progress for sciences and arts.

Forbes bin report say L'Oreal and di Bettencourt Meyers family bin agree to donate $226 million to repair Notre Dame Cathedral afta di April 2019 fire.

According to reports, Ms Bettencourt Meyers value her privacy pass make she dey go social events wey many world wealthy pipo dey often attend.

She dey known to play di piano for several hours a day and she don write two books - one five-volume study of di Bible plus one genealogy of di Greek gods.

"She really dey live inside her own cocoon. She live mainly within di confines of her own family," Tom Sancton, wey write di book, The Bettencourt Affair tok.