BBC Pidgin of Friday, 1 August 2025

Source: BBC

'Me and oda pipo dey suffer, di wahala too much' - patients lament nurses strike for Nigeria

Patients across federal hospitals don begin feel di impact of di nurses and midwives strike Patients across federal hospitals don begin feel di impact of di nurses and midwives strike

Patients across federal hospitals don begin feel di impact of di nurses and midwives strike wey start on Wednesday 30 July.

Di National Association of Nigeria Nurses and Midwives (NANNM) bin announce say di warning strike go last for seven days.

Di strike dey affect only federal goment hospitals and facilities. Di strike dey come afta di association give Nigeria goment 15 days ultimatum to address all di issues wey dey disturb dem.

BBC News Pidgin waka go some hospitals wey federal goment get for Kano, and our tori pesin see pipo worried sake of di strike.

Many sick pipo dey suffer and dem no happy becos of di strike.

Some pipo for di hospital look like relatives of di sick pipo, and e clear say di strike dey affect dem well-well based on how dem dey waka up and down dey worry.

One woman tell BBC News Pidgin say dem carry sick pesin come Malam Aminu Kano Hospital, but now di pesin no dey get di treatment wey e suppose get again.

"We carry our pesin come hospital, dem don even start treatment, but now health workers don go on strike.

"I dey beg goment make dem help us beg di workers make dem come back to work, so dat our children go fit get beta," she tok.

One man wey im name na Rufa'i, wey dey for emergency ward, also tell BBC News Pidgin say as e carry im younger broda wey injure for leg come hospital, di tin wey e meet no sweet am at all.

"I carry my broda come wey get wound for leg, but wen I reach here, I see say workers dey on strike.

"Di tin really pain us, we dey beg pipo wey fit help enta dis mata make dem help us," e tok.

Anoda patient wey dey for male ward tok say e need medical help, but dis strike dey make am hard for am.

"I no well and my sickness need special treatment or maybe even operation, but sake of dis strike, me and oda sick pipo dey suffer. Di wahala don too much."

BBC News Pidgin also visit di University of Port Harcourt Teaching Hospital (UPTH), wia patients for dia dey also feel di impact of di strike and dem don discharge most of dem.

Even though di hospital get a strike action protocol wia dem till dey try to offer some medical services, patients still dey feel di sad impact of di strike as many clinics wey suppose run no dey open.

"Dem still dey offer service for di Accident and Emergency section but dem no dey admit anybody becos nurses no dey on ground.

"I need to see doctor becos of di infection I get for my face but di doctor on duty just prescribe tablets wey I take, even though e say dem suppose admit me to monitor me well, but dem no admit me becos nurses no dey. I pray make dem call off di strike soon," na so George Okpokiri, a patient wey go do hospital tok.

Despite di fact say doctors and oda medical personnel like pharmacist still dey work, di services dey grounded sake of di ongoing nurses strike.



Accident and Emergency ward for University of Port Harcourt Teaching Hospital