You are here: HomeAfricaBBC2023 07 24Article 1811174

BBC Pidgin of Monday, 24 July 2023

Source: BBC

Mass burial burial in Lagos: Goment confirm mass burial but 'no be for EndSARS victims'

Mass burial for victims of #EndSars protest Mass burial for victims of #EndSars protest

Di Lagos state goment don confam tori say dem wan do mass burial for di state.

Di goment however clarify say di mass burial no be for victims of the historic 2020 EndSars protest wey shake di kontri.

Dem specifically say di 103 deadi body dem wey goment wan bury no be from di incident wey happun for Lekki tollgate.

Goment for statement dem release on Sunday insist say dem no see deadi body for di Lekki tollgate.

Tori begin spread over di weekend afta one social media share document wey show say Lagos state goment dey plan mass burial.

Di document wey pipo first tink say na fake show say goment don approve over N60million for di mass burial of 103 deadi body dem.

"For di records, di Lagos State Environmental Health Unit pick up deadi body dem after di #EndSARS violence and community clashes for Fagba, Ketu, Ikorodu, Orile, Ajegunle, Abule-Egba, Ikeja, Ojota, Ekoro, Ogba, Isolo and Ajah areas of Lagos state," Gbenga Akosile tok.

Akosile wey be Commissioner for Information di South west state add say "Jailbreak bin happun for Ikoyi Prison.

"Di casualties mentioned for di document no be doz incidents and NOT from Lekki Toll-gate as pipo dey allege.

"For di avoidance of doubt, we no collect any deadi body from di Lekki Toll Gate incident.

October 2020 EndSARS protest

October 2020 suppose be Nigeria 60th birthday month but e be period of violence and killings across di west African kontri afta one peaceful protest against police brutality turn bloody.

Di destruction start afta jaguda pipo hijack #EndSARS protests wey thousands of pipo bin dey enta streets across Nigeria to peacefully demonstrate against police brutality for di kontri and end to di SARS police unit.

'Anger and shock', dat na how Nigerians and pipo around di world react to di violence wey happun afta armed security operatives shoot #EndSARS protesters on Tuesday around 6:45pm for Lekki toll gate for Lagos.

Amnesty international bin claim say Nigerian army and police kill at least 12 peaceful #EndSARS protesters for two locations in Lagos wey be Nigeria commercial city.

One Nigerian Disk Jokey DJ Switch wey bin do Instagram live video from Lekki toll gate wen di whole kasala burst say she count 15 deadi bodi dat night alone.

But corona investigation by di Lagos state goment tok say nobody die.