You are here: HomeAfricaBBC2023 08 21Article 1829087

BBC Pidgin of Monday, 21 August 2023

Source: BBC

Manchester United reach final agreement say Mason Greenwood go comot from di club

Mason Greenwood Mason Greenwood

Mason Greenwood go comot from Manchester United by mutual agreement afta a six-month internal investigation into im behaviour.

Greenwood chop arrest in January 2022 sake of allegations surrounding material wey pesin publish online.

Dem later drop di charges against di 21-year-old England international, including attempted rape and assault on 2 February 2023.

"All those involved, including Mason, recognise di difficulties wit im recommencing im career for Manchester United.

"E don therefore dey mutually agreed say dis go be di better tin for am to do so away from Old Trafford, and we go work wit Mason to achieve dat outcome,” Man U tok for statement.

Di club add say, "Based on di evidence available to us, we don come to di conclusion say material wey dem post online no provide full picture and say Mason no commit di offences wey make dem charge am.

“As we don tok dat one, as Mason publicly agree today, im don make mistakes wey don take responsibility for."

We dey update dis tori