French President Emmanuel Macron don gree say France forces do bad bad tins for Cameroon during dia struggle for independence and even afta.
Dis na afta one joint report by sabi history pipo from France and Cameroon wey chook eye for France suppression of independence movements from 1945 to 1971.
For one letter to di Cameroon president Paul Biya wey don comot for public on Tuesday, Macron tok say di report dey clear say "war happun for Cameroon during di time di colonial authorities and di French army bin dey show some regions for di kontri real pepper."
"Na me go carry di role and responsibility for those France events," im tok.
But Macron neva issue clear apology for those bad tins wey di French troops do for di kontri wey don finally gain independence for 1960.
Di France leader bin remember four independence icons wey dem kill during military operations by di French forces, including Ruben Um Nyobe, di ogbonge leader of di anti-colonialist UPC party.
France bin push hundreds of thousands of Cameroonians into detention camps wey dem support brutalities just to stop di struggle for independence, di AFP news agency bin quote di report.
Dem don kill tens of thousands of pipo between 1956 and 1961, di sabi history pipos report tok.
Macron bin make di decision to investigate and publish di findings of di role France play for di kontris independence struggle for 2022, when im visit Yaunde.
Dis come afta pipo from di kontri bin put pressure for France to accept say dem do bad bad tins for dia former colony, wey dem gat to pay reparation.
Macron promise say im go work wit Cameroon to promote more research on top dis mata – wey im tok say di findings gat to dey available for universities and oda scientific bodies.
Di BBC don reach out to di Cameroon govment for comment on di French president im admission.
Even though Macron neva address di call for reparations, e dey likely to be di main point for Cameroon for future.
Under Macron, France don try to deal wit dia brutal colonial past.
Last year, di kontri bin acknowledge for di first time say dia soldiers don carry out "massacre" for Senegal in which dem kill West African troops for 1944.
Bifor now Macron don agree to di role France bin play for di Rwanda genocide wia about 800,000 ethnic Tutsis and moderate Hutus die, wey im ask for forgiveness.
For 2021, im tok say France neva listen to di warning of di bloodshed wey for long time, dem bin "value silence over examination of di truth".

Investigation into atrocities by France for Cameroon happun afta pressure from di Central African kontri











