You are here: HomeAfricaBBC2023 10 20Article 1865774

BBC Pidgin of Friday, 20 October 2023

Source: BBC

Lupita Nyongo'o tok why she break up with her boyfriend

Actress Lupita Nyongo'o and Selema Masekela Actress Lupita Nyongo'o and Selema Masekela

Actress Lupita Nyongo'o don announce her break up from her partner, Selema Masekela.

Di Black Panther and 12 Years A Slave star announce di split for social media wey she tok say na because of lost of trust.

Since she post di initial post, she don dey post inspirational breakup post for her Instagram posts.

For di announcement post wey she post on her feed, Lupita tok say, "I find myself for season of heartbreak sake of love wey quickly and painfully don end because of lie-lie".

She describe her ex as "pesin wey I no fit trust again".

She tok say she dey announce di split "to keep am 100 and with hope say di knowledge of my experience fit help pesin out dia wey dey face di grip of heartbreak wey wan try and escape di pain and fit miss out on di wisdom wey go comot from am."

View this post on Instagram

A post shared by Lupita Nyong'o (@lupitanyongo)



Many celebs plus including Gabriella Union, Asisat Oshoala, Marlon Wayans and High School musical star Vanessa Hudgens chook mouth for di mata,

Actress Niecey Nash tok say, "You are not alone" while Vanessa write for three separate comments say "Thanks for sharing and you've got this".

Actor and Comedian, Marlon Wayans advice say "Trust God, e want beta for you. All lessons na blessings especially painful ones. Dis one sef go pass. Warmest of hugs. Be Kind as you dey heal. I dey always tok wen I break up say lucky me, na time to love me again, I miss you me. Go love you woman."

As at right now, US based TV host Masekela neva tok anytin on top di breakup although dem don both comot dia relationship posts rom dia social media and unfollow each oda.

Lupita bin launch oga Masekela as her partner on top social media, with Instagram reel wey show di couple dey match each oda cloth.

For di now deleted post, she reveal say, "We just click" for December 2022.

Di tori of di breakup between di two of dem shock stars and fans alike wey ship dem wella.

Dis na because for 2016, oga Masekela bin tweet for X say, "make we just say you siddon behind Lupita Nyongo'o for plane. Wetin go be your opening line?"

Di A-list actress wey become di frst Kenyan and second African to collect Oscar no dey usually comot in public with di pipo wey she don dey inside relationship with.

So who come be di man wey make am break her privacy on relationship mata.

Who be Selema Masekela?

Selema Masekela na di son of di ogbonge South African jazz musician Hugh Masekela.

E be television personality wey don work for different networks wey include E! wia im bin dey host di show The Daily 10.

E don also work as sport correspondent for di Summer Olympics for NBC

As at now, e dey work as one of di hosts for di ESPN X Games.

According to People Magazine, Masekela dey also do music by di side as e dey for di band Alekesam and dem don feature im songs for shows like HBO Entourage and Showtime House of Lies.

Di 51-year-old TV host also get oda business concerns wey include one surf board company.