You are here: HomeAfricaBBC2023 06 17Article 1787789

BBC Pidgin of Saturday, 17 June 2023

Source: BBC

Lhubirira school attack: Rebels kill 25 pipo for Uganda secondary school

Dem dey hold and comfort one boy for di scene of di attack for Mpondwe, Uganda on 17 June 2023 Dem dey hold and comfort one boy for di scene of di attack for Mpondwe, Uganda on 17 June 2023

Rebels wey dey linked to di Islamic State group don kill at least 25 pipo for one school inside western Uganda.

Anoda eight pipo dey in a critical condition afta di attack on Lhubirira secondary school for Mpondwe.

Police say di attack wey happun on Friday dey carried out by di Allied Democratic Forces (ADF) - one Ugandan group wey dey based for di Democratic Republic of Congo.

Sojas dey pursue di group wey run towards Virunga National park for DRC, police add.

Some of di boys dey burnt or hacked to death, Major General Dick Olum from di Ugandan army tell tori pipo.

Di group kidnap odas from di school, mostly girls, e add.

Tori be say some of di bodies dey badly burnt and go need DNA tests to identify dem.

Reports say di attackers set fire for di students dia mattresses and tori be say dem also set off bombs for di region.

Some members of di wider community fit possibly dey among di dead. Some students also remain unaccounted for.

Sojas dey pursue di group wey run towards Virunga National park for DRC - wey be Africa oldest and largest national park wey be home to rare species, including mountain gorillas.

Militias including di ADF dey also use di area, wey share border wit Uganda and Rwanda, as a hideout.

"Our forces dey pursue di enemy to rescue those abducted and destroy dis group," defence spokesperson Felix Kulayigye tok on Twitter.

Di Ugandan army don also deploy planes to help track di rebel group.

Uganda and di DRC bin don hold joint military operations for di east Congo to prevent attacks by di ADF.

Security forces bin get intelligence say rebels bin dey di border area for di DRC side for at least two days before Friday night attack, Major General Olum tok.

'First of im kind in 25 years'

Di deadly episode dey come afta last week attack by suspected ADF fighters for one village for di DRC near di Ugandan border. Over 100 villagers run go Uganda but dem don return.

Di attack on di school, wey dey located less dan two kilometres (1.25 miles) from Uganda border with DRC, na di first of dat kain attack on a Ugandan school for many years.

For June 1998, 80 students dey burnt to death for dia dormitories inside one ADF attack on Kichwamba Technical Institute near di border of DRC. Dem kidnap More aan 100 students.

ADF form for eastern Uganda for di 1990s and carry arms against long-serving President, Yoweri Museveni, onto allegation say goment dey persecute di Muslims.

Afta Ugandan army defeat dem for 2001, dem relocate go d North Kivu province for DRC.

Dem arrest di group principal founder, Jamil Makulu, for Tanzania in 2015 and e dey custody for one Ugandan prison.

ADF rebels don dey operate from inside di DRC for di last 20 years..

Makulu successor, Musa Seka Baluku, according to reports, first pledge allegiance to di Islamic State group for 2016, but not until April 2019 wey IS first tok about dia activity for di area.

For 2021, suicide bombings for Uganda capital Kampala and oda parts of di kontri bin dey blamed on di ADF.