You are here: HomeAfricaBBC2023 09 12Article 1843010

BBC Pidgin of Tuesday, 12 September 2023

Source: BBC

Kim don enter Russia for suspected arms discussion wit Putin

Kim Jon-Un Kim Jon-Un

North Korean leader Kim Jong Un dey expected to meet wit president Vladimir Putin for Russia.

Di meeting between di two leaders go hold on Tuesday – tori be say Kim don land di port city of Vladivostok via rail.

Di meeting between di two leaders go happun "in coming days", afta di conclusion of di Eastern Economic Forum, di Kremlin don tok.

Kim carry top military officials follow body for dis trip. Di two kontris dey expected to finalise arms deal wey fit see Pyongyang supply weapons to fuel Russia war in Ukraine.

Di North fit in turn get di humanitarian aid wey dem don dey look for sake of di many sanctions wey di kontri dey suffer.

Dis dey come despite several warnings from di US to di North against helping to arm Russia.

Di Kremlin don tok say Russia no dey "interested" in Washington warnings and go instead focus on di interests of Pyongyang and Moscow.

"While implementing our relations wit our neighbours, including North Korea, di interests of our two kontris dey important to us, and no be warnings from Washington.

"Na di interests of our two kontris wey we go focus on," Kremlin spokesman Dmitry Peskov tok.

For early mor-mor on Tuesday Kim leave im train to meet Russian representatives wen e move enta di border station of Khasan, Reuters news agency report, citing an unnamed source.