One street vendor wey police shoot for head during protests two weeks ago don die, one day afta dem declare am brain-dead for hospital, im family tok.
"Boniface no dey again. We just view im body," di family tok-tok pesin Emily Wanjira tell BBC:
Boniface Kariuki family bin earlier tok say doctors bin inform dem say di mask seller brain don stop to function, although im heart bin still dey beat wit life-machine support.
Di family dey expected to issue formal statement about di 24-year-old death later dis Monday.
Boniface Kariuki bin dey caught for crossfire wen police clamp down on one protest for di capital Nairobi against di death of blogger and teacher Albert Ojwang, 31 wey die for police custody.
E bin dey on life support for nearly two weeks afta police shoot at close range during demonstration on 17 June.
Dem declare am brain dead barely 48 hours bifor medics confam im death.
According to im family, doctors bin tell dem say im organs still dey function, but activity no dey im brain, di doctors declare am brain dead.
Doctors bin carry out plenty operations since im admission but some bullet fragments according to reports still dey for im brain.
Tori say e dey brain dead bin spark further public anger ova alleged police brutality, wit increasing demands for justice.
Many Kenyans don also urge di goment to settle di rising hospital bill afta Mr Kariuki family beg for public donations.
Two police officers don show for court on top im shooting, but dem neva ask dem to tok. Dem still dey for custody pending di outcome of investigations.
At least 19 pipo die during nationwide anti-government demonstrations last Wednesday, according to di state-funded rights body.
Kenya interior minister Kipchumba Murkomen, however, defend di police, e describe di protests as "terrorism disguised as dissent".
E urge officers to "shoot on sight" civilians wey attack police stations, wey further spark criticism from lawyers and rights groups.
On Sunday, 29 June, Oga Kariuki family bin ask authorities to speed up investigations and ensure say justice take place.
Dem don charge six pipo - including three police officers - wit di murder of Ojwang death for police custody.
Im death force Kenya deputy police chief Eliud Lagat to step aside, but many Kenyans dey demand im resignation.
Dem detain Ojwang afta Oga Lagat file one complaint, wey accuse am say e defame am on social media.
One autopsy wey authorities carry out discover say Mr Ojwang die of assault wounds. Mr Lagat don deny any wrongdoing.
Wetin "Brain death" mean?
Brain death na clinical and legal definition of death, according to di National Institute of Health. E mean say sake of extreme and serious trauma or injury to di brain, di body blood supply to di brain don dey blocked, and di brain go die.
Pesin wey dem declare brain dead still fit show signs of life such as warm skin, heartbeat, and chest wey dey rise and fall wit di aid of ventilation. Even though di pesin fit appear to be alive, di brain dey significantly damaged and recovery dey impossible.
Pesin wey dey brain dead dey legally confirmed as dead. Dem no get chance of recovery bicos dia body no fit survive without artificial life support.
To determine say pesin say brain dead, doctors go conduct several comprehensive tests to confam say activity no dey di brain in accordance wit strict medical standards.
<>Wetin be di main cause of brain death?
Brain death fit happun wen di supply of blood and oxygen to di brain stop. Di brain need blood and oxygen to function, so any serious injury or sickness wey fit stop blood and oxygen from di brain fit cause brain death.
According to NHS, many things fit cause severe, permanent brain damage wey dey lead to brain death.#
Such as;
.Cardiac arrest – wen di heart stop to dey breathe and di brain no get oxygen.
.Heart attack – wen di blood supply to di heart suddenly block
.Stroke – wen di blood supply to di brain dey blocked or interrupted
.Blood clot – blockage for one blood vessel wey disturb or block di flow of blood around your body
.Severe head injury
.Brain haemorrhage
.Infections, such as encephalitis
.Brain tumour
Brain death different from coma?
Brain death no be di same same as coma, bicos pesin wey dey for coma dey unconscious but still alive.
NHS say pesin wey dey for vegetative state still get functioning brain stem, wey mean say some form of consciousness still fit dey. E dey awake but e no show any sign of awareness, and slim chance of recovery dey, bicos di brain stem core function still fit dey unaffected.
"Most pipo dey come out from comas within two weeks. In brain death, pesin no dey ever regain consciousness sake of permanent loss of brain function, wey dey completely irreversible," sabi pipo tok.











