BBC Pidgin of Friday, 4 July 2025

Source: BBC

Katy Perry and Orlando Bloom confam breakup

Katy Perry and Orlando Bloom dey romantically linked since 2016 Katy Perry and Orlando Bloom dey romantically linked since 2016

Pop star Katy Perry and actor Orlando Bloom don officially confam say dem dey breakup.

According to US media outlets, dis breakup dey come six years afta dem get engaged

Di couple dey romantically linked since 2016 and get a four-year-old daughter.

For a joint statement wey dem issue to US media outlets, representatives for di couple say di two of dem bin dey "shift dia relationship ova di past many months to focus on co-parenting".

"Dem go kontinu to dey seen togeda as a family, as dia shared priority na and go always be to raise dia daughter wit love, stability and mutual respect."

Dem release di statement sake of "abundance of recent interest and conversation" wey surround dia relationship.

Di pop star, 40, and di 48-year-old actor breakup for 2017 but get back togeda shortly afta. Dia engagement na for Valentine Day for 2019.

A year later Perry reveal say she get belle for di music video for her single Never Worn White.

Dem born dia daughter Daisy Dove later dat year, wit Unicef wey announce di news for dia Instagram account. Both Perry and Bloom na goodwill ambassadors for di United Nations agency wey dey help pikin

Di breakup follow a tough year for Perry. Her most recent album, 143, and di lead single Woman World, no dey as well received as her previous music.

Di singer dey currently on tour, but ticket sales dey reportedly slower dan earlier for her career.

Perry and a group of oda female celebrities also faced gbas-gbos afta dia Blue Origin space trip for April, Perry say di reactions leave her feeling "battered and bruised".

Di US singer, wey dey previously married to Russell Brand, shoot to fame for 2008 wit di single I Kissed A Girl, wey reach number one for di UK.

Her hits since den include Roar, California Gurls, Firework and Never Really Over.

Bloom dey previously dey married to Australian model Miranda Kerr, and dem get a son, 14-year-old Flynn.

Di British actor don feature for Pirates Of The Caribbean, The Lord of the Rings and The Hobbit.