BBC Pidgin of Tuesday, 17 February 2026
Source: BBC
Jesse Jackson, wey be celebrated civil rights leader don die early on Tuesday, afta battling di neurodegenerative disorder Progressive Supranuclear Palsy (PSP), im family tok inside one statement.
Jesse Jackson na di first African-American to make di jump from activism to major-party presidential politics.
As Martin Luther King Jr. protege, Jackson build im career to dey organise politically and beta life for African-Americans, and e become national force during im two White House campaigns.
While oda African Americans dey try aim for US presidency, Jackson na di first wey find significant success for ballot – wey open door for pipo like Barack Obama and Kamala Harris