BBC Pidgin of Tuesday, 23 September 2025

Source: BBC

Israeli tanks dey move enta inside Gaza City, Trump ready to address UN General Assembly

President Donald Trump ready to address UN General Assembly President Donald Trump ready to address UN General Assembly

As world leaders including US President Donald Trump gada for di UN General Assembly, tanks and armoured vehicles wey belong to di Israeli don move enta Gaza City.

Israeli forces dey kontinu dia ground offensive to fully occupy Gaza City as witnesses report say tanks don enta into di city centre from di north and south.

Di locals say Israeli artillery shelling and attacks by quadcopter drones dey drive pipo comot from dia homes for Gaza City. Israel dey use armoured vehicles wey get explosives to blow up blocks of houses.

Meanwhile, as dis entrance into Gaza City and attacks dey go on, US President Trump dey prepare to address di 80th annual UN General Assembly wey dey happun for New York later today.

Trump also dey expected to meet leaders from di Middle East for separate meeting for di UN afta im address.

Part of wetin Trump dey expected to mention na di situation wey dey go on for Gaza and di Israeli attacks, including di recognition of Palestinian state by some kontris.

Several kontris don formally recognise Palestinian statehood ova di past two days as Israel dey kontinu dia assault on Gaza City.

France, wey dey co-host di event wit Saudi Arabia, don join list of kontris wey formally recognise Palestinian state afta similar announcements from di UK, Canada and Australia on Sunday.

Although, Trump no attend di pre-assembly conference for di two-state solution to di Israel-Gaza conflict, but im address today go touch on plenti tins.

Trump go still host di Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu for 29 September 2025, but bifor dat e go do meetings wit officials from UAE, Qatar, Egypt, Jordan, Turkey, Indonesia and Pakistan to discuss di situation for Gaza on Tuesday afternoon.

Meanwhile, di US don criticised di move to recognise Palestinian state and di two-state solution dey no go help to end di conflict as Israeli Prime Minister Netanyahu tok say "Palestinian state no go dey".

Wetin be di two-state solution?

During di UN summit on Monday, focus dey on di plans for two-state solution to end di conflict for Gaza.

But wetin dem exactly mean by two-state solution?

Dis na internationally backed plan for peace between Israel and di Palestinians

Dem dey propose independent Palestinian state for di West Bank and Gaza, wit East Jerusalem as di capital.

Howeva, Israel reject two-state solution wia dem say final settlement gatz be di result of negotiations wit di Palestinians.

Di Palestinian Authority wey dey set up for di peace agreements if 1990s backs di two-state solution but Hamas no accept am becos dem oppose di existence of Israel.

Leaders for UN call for war to end for Gaza

France President Emmanuel Macron say France join di UK, Canada, Australia and Portugal to formally recognise Palestinian state.

Di French leader also call for di release of Israeli hostages wey Hamas hold and make dem end di war for Gaza. E say notin fity justify di war wey dey go on for Gaza.

UN General Secretary Antonio Guterres also warn Israel make dem respond wit plan to expand di West Bank.

Palestinian President Mahmoud Abbas wey join di conference call for Hamas make dem surrender dia weapons as e dey look ahead to future for Gaza wey no go include.

Israel and and dia closest ally di US no attend di meeting wia dem propose di tw-state solution.

Dem dey among di minority of UN members wey no recognise Palestinian state, and dem condemn announcements to recognise Palestinian state.

Howeva, US President Trump address later today to show im stand ontop di war for Gaza and recognition of Palestinian state.



As world leaders including US President Donald Trump gada for di UN General Assembly, tanks and armoured vehicles wey belong to di Israeli don move enta Gaza City