BBC Pidgin of Monday, 11 August 2025
Source: BBC
Five Al Jazeera journalists including prominent reporter Anas al-Sharif don die afta one Israeli strike near Gaza City Al-Shifa Hospital, di broadcaster tok.
Al-Sharif and anoda correspondent, Mohammed Qreiqeh, along wit cameramen Ibrahim Zaher, Mohammed Noufal and Moamen Aliwa bin dey inside tent wey journalists dey for di hospital main gate wen di strike hit dem, Al Jazeera report.
Di "targeted assassination" on Sunday na "yet anoda obvious and deliberate attack on press freedom", dem tok for statement.
Di Israel Defense Forces (IDF) confam say dem don target Anas al-Sharif, alleging say di place "serve as di head of a terrorist cell for Hamas".
Dem also say dem get "advanced rocket attacks on Israeli civilians and IDF troops".
Di Committee to Protect Journalists (CPJ) say dem dem dey shocked by di attack and say Israel don fail to provide evidence to back up dia allegations against al-Sharif.
"Dis na di pattern wey we don see from Israel – no be just for dis current war, but e don tey – in a case wia Israeli forces go kill journalists and the Israel go later call dem terrorist, but provide very little evidence to back up dia claims," CPJ CEO Jodie Ginsberg tell di BBC.
Al Jazeera managing editor Mohamed Moawad tell BBC say al-Sharif na accredited journalist wey be "di only voice" for di world to know wetin dey happun for di Gaza Strip.
Throughout di war, Israel neva allow international journalists enta inside Gaza to report freely. Diafore, many outlets rely on local reporters within di territory for coverage.
"Dem target dem inside dia own tent, dem no even dey cover from di front line," Moawad tok of di Israeli strike.
"Di fact be say di Israeli goment wan silence di coverage of any channel of reporting from inside Gaza," e tell The Newsroom programme.
"Dis na sometin wey I neva see bifor for modern history."
Al-Sharif, 28, appear to dey post on X just bifor im death, wia e dey warn of intense Israeli bombardment within Gaza City. Post wey dey published afta tori come out say e don die appear like sometin wey dem plan and one friend publish am.
For two violent videos afta di strike, wey BBC Verify don confam, e show as men dey carry di deadibodi of pipo wey dem kill.
Some bin shout Qreiqeh name and one man wey bin dey wia media vest say one of di bodi dem na of al-Sharif.
All in all, na seven pipo die for di strike, na so Al Jazeera tok. Di broadcaster bin first tok say four of dia staff members na im dem kill but few hours later, dem comot to tok say na five die.
Last month, di Al Jazeera Media Nations togeda wit di United Nations and di CPJ comot separate statements wey warn say al-Sharif life dey in danger and call for im protection.
IDF tok-tok pesin Avichai Adraee bin post one video for X and accuse am say e be member of Hamas military wing.
Irene Khan, one UN special rapporteur for freedom of expression call am "unsubstantiated claim" and "blatant assault on tori pipo".
Dat time, she tok say "growing proof dey say tori pipo for Gaza don dey targeted and killed by di Israeli army on top unsubstantiated claims say dem be Hamas terrorists"
For dia newest statement, di IDF accuse al-Sharif say e dey disguise as tori pesin and say dem bin get "disclosed intelligence" bifor say e get military link wey include "list of terrorist training courses".
Dis no be di first time wey di IDF don target and kill AL Jazeera tori pipo for Gaza wey dem claim say get links wit Hamas. Dis na claim wey Al Jazeera reject.
According to di CPJ, 186 tori pesin don dey confirmed say dem kpai since di start of Israel military offensive for Gaza in October 2023.
For di tori pipo wey still dey Gaza, di mata don red. No be di air strikes be dia only problem, also dia be threats of starvation.
Last month, di BBC and three news agencies wey be Reuters, AP and AFP, collabo drop statement wia dem express "desperate worry" for tori pipo for di Strip, say dem dey find am harder and harder to feed diasef and dia families.
Three freelancers wey BBC dey use well for di coverage say dem dey normally go for days without say dem chop and one of dem even collapse for feeming.
Ova 100 international aid organisations and human rights groups don warn say mass starvation dey Gaza. But Israel, wey dey control di entry of aid supplies enta Gaza don accuse charities say dem dey "serve di propaganda of Hamas".
Israel bin start dia offensive as ansa to di Hamas attack on southern Israel for 7 October 2023, wia dem kill like 1,200 and take 251 odas as hostage.
Dem don kill ova 61,000 pipo for Gaza since di Israeli military operation start, according to di territory Hamas run health ministry.
