BBC Pidgin of Wednesday, 25 March 2026
Source: BBC
Israel and Iran continue to dey blow up each oda on Wednesday as Iran military reject President Donald Trump tok say US dey do negotiation wit dem to end di war, Iran say US dey negotiate wit demsefs.
Top spokesperson of Iran joint military command Ebrahim Zolfaqari tok for Iran live TV say dem no fit make deal wit pesin like Trump.
E ask, "di level of your inner struggle don reach di stage wia you go dey negotiate wit yasef? Pipo like us no fit get along wit pipo like you.
Iran leadership don tok before say dem no fit negotiate wit US say Washington don attack di kontri two times during high level negotiations for di past two years.
Iran Foreign Ministry Spokesperson Esmaeil Baghaei tell tori pipo say, "Iran get bad experience wit with America diplomacy".
E add say dem no hold any negotiation as Iran armed forces dey focus on defending di kontri.
Since four weeks wey di war start, e don kill thousands, cause di worst energy shock in history and spark global inflation fear.
Israel military tok for telegram post say dem launch wave of airstrikes wey target infrastructure for Tehran. E later tok say dia air force don strike two naval cruise missile production sites for Tehran.
News agency for Iran say di strike hit residential area for di city and rescuers dey search wetin remain.
Kuwait and Saudi Arabia say dem stop fresh drone attacks, but dem no tok wia e from come, dem say e target fuel tank for Kuwait Airport and cause fire but no casualties.
Iran Revolutionary Guard say dem launch new wave of attacks against locations for Tel Aviv and Kiryat Shona and di US bases for Kuwait, Jordan and Bahrain.
Trump bin tell reporters for White House on Tuesday say US dey do negotiation wit di right pipo for Iran to end di war, come add say Iran wan reach deal very badly.
US send 15 points plan to Iran to end di war.
New York Times report on Tuesday say Washington send 15 points plan to Iran to end di war for Middle East. Israel Channel 12 say US want one month long ceasefire to discuss di 15 points plan.
Israel media say di plan include how to dismantle Iran Nuclear programme, how to cease support from Proxy groups like Hezbollah for Lebanon and how to reopen di Strait of Hormuz.
Since di US and Israel begin bomb Iran, Iran in turn begin attack kontris wia US get base, attack gulf energy infrastructure and close di Strait of Hormuz wey be base for a fifth of world oil and liquefied natural gas.
Iran don tell di United Nations Security Council and di International Maritime Organization say non-hostile vessels fit pass through di Strait of Hormuz if dem coordinate with Iran authorities.
As dem close dis waterway wia 20 percent of di world oil and gas dey pass through, e cause worst energy supply shock in history, increase fuel prices and disrupt global aviation.
Asia dey among di worst hit with fuel crises, dem dey buy 80 percent of di crude wey dey pass through di Strait of Hormuz and govment don dey rush to respond to di fuel shortages. Dem dey run policies like work from home and oda measures dem bin enforce during covid era. Some kontris declare public holiday and close schools.
Sake of di situation, di International Energy Agency don agree to release 400 million barrels of oil from stockpiles to deal with di crises.
Pakistan offer to hold US - IRAN talks
Meanwhile, Pakistan Prime Minister Shehbaz Sharif on Tuesday say e ready to host toks between US and Iran to end di war. Dis dey come one day after Trump postpone im threats to bomb Iran power plants after wetin im call "productive" toks.
Pakistan get longstanding ties wit dia neighbor Iran Islamic Republic and dey build relationship wit Trump.
Despite reports of di negotiations, Pentagon still dey expected to send thousands of soldiers from US Army elite 82nd Airborne Division to di Middle East.
Di forces go add to di 50,000 US troops wey already dey di region and e go build up US military buildup for dia.