BBC Pidgin of Monday, 22 December 2025

Source: BBC

Interpol operation gbab ova 570 pipo for 19 African kontris as dem recova $3m

Interpol togeda wit officials from 19 kontris for Africa don collabo to arrest more dan 570 pipo wey dem suspect say dem dey involved for cybercrime and oda yahoo business.

For dis operation wey last for one month from 27 October to 27 November, Interpol say dem recover $3m.

Interpol director of cybercrime Neal Jetton say "di rate of dis crimes for Africa dey rise – especially for di finance and energy sector."

"Di operation in collaboration wit di security officials of di local kontris don protect livelihoods, secure personal data wey e don preserve infrastructure."

Three yahoo types dey involved – wetin dem call business email compromise, digital extortion and ransomware; all dis dey part of di common crime wey Interpol find for dia 2025 Africa cyber threat report.

Dem tok say di cases dem chook eye for, dey linked to financial loss wey plenty pass $21m.

Dis latest operation dey happun afta Interpol decide to crackdown on pipo wey dey do fraud and yahoo for di continent.

Early dis month, police bin arrest Ghanaian socialite wey dey popular as Abu Trica say im dey involve for $8m romance scam for di US.

Di US justice department tok say dem charge am wit conspiracy to commit wire fraud and money laundering.

Ghana authorities dey prepare to extradite di 31-year-old to di US to face trial – if dem find am guilty, he fit spend up to 20 years for jail, according to di US state attorney office.

Bifor Abu Trica, dem arrest oda Ghanaians wey US officials confam say di kontri extradite nine pipo to face different charges of fraud and money laundering in 2025 alone.

Interpol meanwhile say dem go continue to pursue pipo wey still dey engage for fraud and oda cybercrimes for Africa.

Dis 'operation sentinel' target some major groups for some kontris for Africa.

Senegal

According to Interpol, dem find say fraudsters don enta di email system of one petroleum company wey dem use di profile of some of di ogbonge officials to transfer $7.9m. Dem use wetin dey described as business email compromise (BEC). Dis wire transfer na fraudulent. Officials for Senegal freeze di destination account bifor dem fit withdraw di money.

Ghana

Officials for Ghana scata one ogbonge cyberfraud network wey bin dey operate across Ghana and Nigeria; dem allegedly defraud more than 200 pipo over $400k. Di fraudsters use websites and apps wey dem design to copy fast-food brands, wey dem collect money from pipo without delivering dia orders.

Police arrest 10 suspects for Ghana wia dem seize ova 100 digital devices.

Benin

For Benin, officials take down 43 'malicious domains' wey dem scata 4,318 social media accounts linked to extortion schemes and scams. Dem also arrest 106 pipo.

Cameroon

Law enforcement pipo dia react fast fast aft two victims don report one scam involving some online vehicle sales platform. Dem trace di attack to one server wey dem cause bank to freeze di account within hours.

Interpol say di 19 kontris - Benin, Botswana, Burkina Faso, Cameroon, Chad, Congo, Djibouti, Democratic Republic of the Congo collaborate well for dis operation.

Law enforcement agencies for di oda kontris like Gabon, Ghana, Kenya, Malawi, Nigeria, Senegal and South Africa continue to pursue di fraudsters.

South Sudan, Uganda, Zambia and Zimbabwe dey alert.



Interpol director of cybercrime Neal Jetton say "di rate of dis crimes for Africa dey rise - especially for di finance and energy sector".