BBC Pidgin of Friday, 6 February 2026

Source: BBC

Inside di sheabutter museum wey dey heal pipo and showcase Ghana heritage

Hamamat be model and former beauty queen wey dey use culture and natural product to promote Africa Hamamat be model and former beauty queen wey dey use culture and natural product to promote Africa

E no be every time you go get your kontri president to endorse wetin you dey do – especially if e bi sometin wey dey promote di culture and heritage of di kontri.

So wen President John Mahama tok about di sheabutter museum for Accra wia popular American streamer IshowSpeed visit to get 'healing massage' during im 20-nation Africa tour, Hamamat Montia see am as "big deal".

President Mahama tok for one public event say his children show am videos wen IshowSpeed visit di museum wey he see how di 21-year-old streamer enjoy am, he believe say he go return for more.

"One of our northern sisters get dat museum, wey I see how IshowSpeed enjoy di massage wey he open mouth; dat guy go come back to Ghana for more," President Mahama tok as he launch di Shea Park resource hub for di Upper West region of Ghana,

Dat endorsement for Hamamat mean say dem dey do di right tin.

"I no fit believe say di president tok about us; make somebody pinch me. For di president to mention us wey ova 50 million subscribers around di world wey dey follow IshowSpeed to see us and wetin we do, be big tin."

Clips of di massage go viral – as 10 young girls use authentic sheabutter to massage IshowSpeed to end his Ghana tour.

Di girls dey sing one traditional song 'kuriya kuriya – kurjenjen' wey dem dey mix di sheabutter inside big calabash, afta, dem use am rub di bodi of IshowSpeed.

"Dis dey feel good; dis be heaven," Speed tok as he receive di massage wey founder of di museum, Hamamat Montia tok say be medicinal.

Di 37-year-old model tok BBC pidgin say "we give IshowSpeed wetin we call traditional sheabutter massage. For di olden days, dem dey use dis kind therapy for warriors, kings and queens."

"Di 10 ladies use di sheabutter wey we make dat morning to rub his hair, back, waist legs and oda parts of his body to heal am sake of e dey stream for five hours dat day."

I dey happy say we fit showcase di handwork of our women to di world'

Hamamat tok say "for di whole world to see us and how we display our tradition and heritage dat day, e make me proud."

"I dey happy say we fit showcase di handwork of our women to di world – sake of women dey pick di shea nuts, women dey grind dem, women dey use dia hands to make di sheabutter; so di women sef happy say di world see dia hardwork."

Many Ghanaians for social media say dem no sabi say one sheabutter museum like dat dey Accra.

Dat be how many pipo now begin to book to visit di museum.

"Since dat day, we dey get calls from around di kontri and even outside. Pipo dey wan come our museum come learn how to make sheabutter and collect healing & traditional massage."

Hamamat say "sake of dis traffic, our sheabutter spa dey fully booked from now to April. But pipo fit come see how we dey make di sheabutter and even try dia hands to make some by diaserf."

She explain say dem dey look to partner oda spa groups to teach dem how to use sheabutter to do di healing therapy, wey she wan carry dis therapy go outside di kontri to also share wit odas.

"Wit di way we trend, I go hope say di kontri go celebrate dis women wey dey produce di sheabutter; make di govment declare one day as sheabutter day to celebrate di hardwork of women wey dey involve in making dis sheabutter."

Inside di museum, dem get 21 different types of sheabutter from African kontris to show di diversity of culture.

Hamamat wey be founder of di museum say "each sheabutter for hia from di 21 kontris get different properties and texture; some be hard, odas dey smooth, some too be yellow and di one from Senegal be black."

She explain say di difference be sake of di nuts dem dey use for di butter dey grow for different climate and weather conditions.

"Sheabutter – di nuts be food, we dey use di butter for cosmetics; we dey use am for cooking wey we dey use am togeda wit some herbs, for medicine," Hamamat explain.

"Parents fit use sheabutter, palm kernel oil or even coconut oil to treat cold for dia children; e dey work like magic."

She also tok say "historically midwives dey use sheabutter for women wey dey in labour to help dem give birth easy."

Who be Hamamat Montia wey of di sheabutter museum?

Dem born and raise Hamamat for Bolgatanga for di Upper East region of Ghana.

She be model and former beauty queen; she win Miss Malaika beauty pageant in 2006, at dat time she be 17 years.

She later become model of Africa universe in 2007.

Hamamat do many fashion modelling and oda international gigs wey she feature for some commercials wey dey promote tourism and African culture.

She be mama of three children wey she dey teach dem how to promote dia culture through di tins dey wear, dia hair, dia food and odas.

In 2019, she open her sheabutter village for Tamale for di northern region of Ghana wey she open di museum for Accra.

She describe hersef as di seventh generation sheabutter heir from Tamale since her family dey make sheabutter for generations.

"Dis be my time to continue di tradition sake of my family dey into sheabutter long ago, no be today."

Di sheabutter village and di museum open at a time Ghana launch wetin dem call "year of return" for di pipo in di diaspora to return home to Ghana and connect wit dia roots.

Di sheabutter village dey serve as spa, tourist site, hotel for Tamale wia dem dey produce all types of sheabutter.

She dey export dis sheabutter and oda sheabutter products outside Ghana.

She also get big local market for di natural product.

"We build dis museum for 2019 to showcase di value of di women to make sure dem get wetin Africa dey produce for di world for centuries without recognition."


Di museum get 21 types of sheabutter from African kontris, wey dem dey teach visitors how to make dia own sheabutter



IShowSpeed receive traditional healing massage from 10 ladies for di sheabutter museum. Dis be massage wey dem dey use for kings and queens and warriors in di past



For Tamale in Northern Ghana, di sheabutter village dey showcase culture, tourism and offer visitors great connection wit nature and di African heritage



Di SPA section of di museum bin dey oversubscribed after IShowSpeed visit with many wey want similar healing massages