You are here: HomeAfricaBBC2024 05 15Article 1931011

BBC Pidgin of Wednesday, 15 May 2024

Source: BBC

‘I see pipo wey cheat me dey pray’ – Suspect tok why e close door before setting fire inside Mosque for Kano

One pesin don die and 23 odas wunjur afta one man set mosque on fire during morning prayer One pesin don die and 23 odas wunjur afta one man set mosque on fire during morning prayer

One pesin don die and 23 odas wunjur afta one man set mosque on fire during morning prayer for Kano, North west Nigeria.

Di man wey im identity no dey known bin set fire to one mosque for Laraba Abasawa wey dey for Gezawa Local goment area.

Di incident wey happun early on Wednesday make pipo begin run upandan for di area to find how to save and rescue pipo wey trap inside di mosque.

One pesin from di community bin tell BBC News Pidgin say di man pour petrol and set fire for di mosque wen about 40 pipo dey pray - e den lock di mosque.

Di chief medical director, Murtala Muhammad Specialist Hospital, Dr Hussaini Muhammad, wey bin attend to di patients, tok say 24 pipo na im dem carry come di hospital.

E add say, one of dem bin don die bifor dem reach di hospital.

"My broda die instantly afta we carry am come hospital". Brother of di deceased worshipper, Muttaka Halliru, tok.

Haliru add say "At di time wen di fire happun, I dey house dey prepare to go for Sub'h prayer, den I hear Sulaiman dey shout fire for mosque."

"Di remaining 22 pipo, get serious injury, sake of say plenty of dem get burn from head reach toe, while di oda one get burn for im back and hand," e tok.

However, Kano Police tok say dem don arrest one man wey dem believe say na im set di mosque on fire during di early morning Sub'h prayer.

Dem tok dis one for one statement wey Police tok-tok pesin SP Abdullahi Haruna Kiyawa release for im social media.

Di suspect wey be 38 years, tok say im action na sake of wahala wey e dey get wit im family members sake of inheritance.

E tell police pipo say im family dem no share di inheritance well, and those wey e believe say cheat am be di pipo wey dey for mosque wen e bin torch am, di statement tok.

SP Abdullahi Haruna Kiyawa tok say dem dey hold di suspect for police station as dem kontinu to investigate di matter.