Di Sierra Leone Police don declare popular musician Natasha Beckley wanted sake of allegations wey surround narcotic drugs but she say she no dey on di run.
Sierra Leone police make di declaration for Wednesday 8 October 2025, say Beckley allegedly dey in "connection wit production and distribution of narcotic drugs."
Police claim say dem search her house wia dem find some drugs, but Natasha deny say no be her house dem search.
Meanwhile, di declaration of di Sierra Leone police dey come few days afta Natasha Beckley bin declare her political ambition to run for di deputy chairperson position for Port loko district under opposition party, All People Congress (APC).
Natasha Beckley na former beauty pageant wey be Miss Sierra Leone bifor and she dey popular for her rap music for Sierra Leone.
Wen di police bin post her picture and declare her wanted, she reply say she no dey on di run and no be her house di police bin search.
"Dem no arrest me, my house no dey searched, I no dey on di run , I be law abiding citizen and I go cooperate wit Sierra Leone police," she write for her Facebook page on Tuesday 8 October 2025.
Wetin make police declare Natasha Beckley wanted
According to Sierra Leone Police, dem say dem conduct one operation for 13 June 2025 for one "no. 8 Campbell Lane, off Taylor Street, Fourah Bay Road, Freetown' wia dem uncova materials wey dem suspect say na for di 'processing of Kush.'
Kush na locally produced synthetic drug and Sierra Leone dey battle serious drug problem according to dia local media reports.
Di police say wen dem bin raid di house, dem find "nine polythene bags wey contain shredded leaves wey dem suspect say na marshmallow, five one-gallon containers wey dey label "Acetone", chemical precursor; three gas masks; and five old weighing scales wey dem believe say dey used for drug sales."
Sierra Leone claim say dem don try catch Beckley bifor but she run and now dem dey beg make di public help dem supply informate wey go lead to her arrest.
'I no get property for Freetown' - Natasha Beckley reply Sierra Leone police
Howeva, Sierra Leone APC aspirant Beckley wey dem accuse don tok say all wetin di police tok na lie,
According to di Sierra Leonean musician, she say her dey 'property dey Port loko and not Freetown' and she don contact di police say she go show up wit her lawyers.
Di former Miss Sierra Leone turned politician say she dey house and she dey fine but say na some pipo no want make she qualify for di political position wey she dey contest for.
"So many odds against me, and dem wan intimidate me to back down. Several meeting and deliberation wan change my mind , I say no I wan work for Port loko.
"Dem want make I live in fear, fly out of di kontri so I no go qualify for elections. dem make I step down and find position wey dey suitable for women."
According to Natasha wey dey popular as Freetown finest, she say dem wan give police record so she no go qualify to participate for di elections.
She accuse Sierra Police say if dem truly dey find her, why dem no arrest her wen she dey publicly declare her political ambition.
"If you dey look for me for months why you no arrest me for Saturday 4 October, as I dey publicly declared for political office?"
"Di police no dey my house, dem neva come and dem no dey look for me."
Who be Natasha Beckley
Miss Natasha Beckley na popular Sierra Leone musician wey don make her mark for di pageant stage around di world.
Natasha Beckley don represent Sierra Leone so well for beauty pageantry and she win some titles.
For 2009, Natasha Beckley represent Sierra Leone for di Miss Africa USA Pageant. Bifor dat time, she don win Crown of Miss Sierra Leone for District of Columbia.
Natasha na Poet and for di Miss Africa USA Pageant, she bin win di First Runner Up.
For 2011, Natasha become Miss Sierra Leone World for 2011 and again she represent Sierra Leone for di 2011 Miss World Pageant.
She dey among di top 50 finalists dat time.
Her achievements make her dey recognised by di den President Bai Koroma, former President of of Sierra Leone.
Natasha Beckley enta di music scene for Sierra Leone wia she she win awards wey include di best female rap artist for 2025.
She bin transition into politics, first she be aspirant for MP position under APC for Port Loko for 2018. By 2023, she contest Mayor position for Port Loko city council.
And now she be aspirant for deputy chair aspirant under APC for Port Loko.











