US President Donald Trump don tok for di memorial service for Charlie Kirk wey be di conservative activist wey dem shoot kill earlier dis month.
Trump hail am say e be di "giant of his generation" and tok say America na "nation wey dey in shock and dey mourn" while Vice President JD Vance tok say e "change di course of history".
Tens of thousands of pipo bin gada for State Farm Stadium for Glendale, Arizona to do remembrance for KirK.
Kirk widow Erika as she dey cry tell di crowd say she forgive di man wey kpai her husband .
Oda tins wey sup for di event na di first appearance of Trump and Elon Musk togeda since dem fight for outside earlier dis year, as dem shake each oda.
But even in di midst of pipo wey dey hail Kirk, Trump and some oda speakers for di event still tok to di crowd from behind one glass wall.
Donald Trump start im tok for di event behind glass wall say, "today, America na nation in grief and shock and mourning".
E say Kirk bin dey "killed by radicalised cold-blodded monster sake of say im speak di truth wey dey im heart".
E tell di packed stadium say, "Charlie fit always draw crowd".
Trump tok sat one of di last tins wey Kirk bin tell am na "abeg sir, save Chicago".
Trump say e go run am as speculation dey fly say Trump fit send National Guard go dia like e send go Washington DC.
Di president also hail Charlie Kirk say na him unite Maga and Maha, wey be Make America Healthy Again.
Trump tok say, "Tomorrow we go get one of di biggest medical announcement for di history of our kontri. I tink we don find di ansa to autism".
Dis na as sabi pipo don tok say di ansa no straightforward like dat as dem don dey study di conditions for decades.
Trump say while Kirk no hate im opponents and bin want di best for dem, no be so for am.
E tok say, "na wia I no gree wit Charlie be dat. I hate my opponent and I no want beta for dem".
E come joke say Charlie go vex for am say e tok dat kain tin.
'I forgive di pesin wey kill my husband' - Erika Kirk
Charlie Kirk wife, Erika bin dey cry sometimes as she tok about her relationship wit her husband and promise say she go continue im work.
She tok say, "I see di wound wey end im life. I feel evritin wey e go expect say I go feel. Shock, horror and di kain heartache wey I neva know exist.
"Dis past 10 days since dem kill Charlie, we no see kasala, we no see rioting, we no see revolution. Instead wetin we dey see na wetin my husband bin pray say we go see for dis kontri, we see revival."
She den tok say she don forgive her husband alleged killer wey be 22 year old Tyler Robinson. Mrs Kirk tok say, "dat young man, I forgive am. I forgive am bicos na wetin Christ do and na wetin Charlie for do".
Mrs Kirk na businesswoman and former Miss Arizona USA winner wey meet Charlie Kirk for 2018 and marry am for 2021.
Erika don dey study for doctorate for Bible studies don start Bible ministry programme and dey host di Midweek Rise Up podcast wey dey tok about Biblical leadership.
She now be di oga for Turning Point USA wey be platform wey she form togeda wit her late husband.
Di couple don born one year old son and three year old daughter.
Wetin happun for di event gan-gan?
Di event bin dey described say e resemble political rally or service for mega church.
As apart from di tok-tok wey di president and vice president and oda White House Officials tok, di event also get Christian bands wey perform and also do prayers for di crowd wey be almost 100,000 pipo.
Oda speakers include members of Kirk joinbodi, Turning Point USA, wey dia main focus na conservative activism for college campus as well as oda popular pipo for di conservative movement.
Plenti of di speakers say dem believe say im death go ginger di conservative movement for America. Di movement don alreadi dey powerful position sake of say Trump get White House and di Republican get di Congress.
Even Elon Musk wey publicly fight wit Trump earlier dis year snap picture wit am wey im post and caption "For Charlie".
Who be Charlie Kirk?
Charlie Kirk na one of di most high-profile conservative activists and media personalities for di US and trusted ally of President Donald Trump.
Kirk wey be 31 years old dey known for holding open-air debates on campuses across di kontri.
For 2012, at di age of 18, e bin co-found Turning Point USA (TPUSA), wey be student organisation wey aim to spread conservative ideals for liberal-leaning US colleges.
Im social media and daily podcast dey usually share videos of how e dey debate wit students about issues such as transgender identity, climate change, faith and family values.
Kirk wey be di son of architect grow up for well-to-do Chicago suburb of Prospect Heights.
E bin attend community college near Chicago bifor e drop out to devote imsef to political activism. E bin apply unsuccessfully for West Point, di elite US military academy.
Kirk bin marry one former Miss Arizona, and dem get two children togeda. Dem see Kirk as both di future of conservative activism and highly polarising figure.











