You are here: HomeAfricaBBC2023 01 18Article 1697672

BBC Pidgin of Wednesday, 18 January 2023

Source: BBC

Husband want justice for im new bride wey her eye damage during fight for dia wedding ceremony

Di mata happun for Kano State for Northern Nigeria Di mata happun for Kano State for Northern Nigeria

Wetin bin start as one of di most important weekend for dia lives end in tragedy for one couple for Kano state wey dey northwest Nigeria afta di bride suffer serious injury for eye afta fight break out during wedding celebration.

At di moment, many pipo for di area dey fear say di bride Khadija don lose one of her eyes afta she faint as a result of stone wey pesin use stone her for eye.

Di young bride Khadija Abdullahi with her friends and family call DJ to play music for dem in front of her house for Kwalajawa area of Kano city not knowing all di dancing go end on a sour note.

Hamza Bala na di groom and recount wetin happun to BBC saying e no go gree and justice must be served for wetin happun to im new wife.

“My bride and her pipo all women organise traditional DJ music as part of our wedding celebration and next tin dem say some vigilante pipo storm di place.”

“I just get call say my bride faint and dey hospital na so I rush go dia to see wetin dey happun and by di time I reach dia, she just dey cry na dia I hear say na stone dem use hit her for eye.”

“Afta she regain consciousness, dem carry us go meet eye specialists on di mata because na bandage dem use cover her eye.”

Hamza say wetin e want now na for di pipo wey dey behind di injury to im bride to pay for wetin dem do so as serve as lesson.

“At di moment, Police don arrest two pipo over di mata and I dey seek justice for my bride.”

“For di fight wey happun na only my wife suffer serious injury and no one else.”

“Na very bad tin happun because na day wey suppose be happy day but bad tin come happun e make me sad.”

Hamza say dem still dey hospital on di mata but e get doctor wey assure dem say hope dey regarding di injured eye.

Wen BBC ask di groom if di incident go change anytin for am, e say no.

“Of course no. I go love her like dat. Wetin happun I take as destiny from God so notin go change my love for her.”

Hamza say at di moment, di bride still neva smell im house because na all about her health at di moment.

“She neva come my house as na her health be priority now but di tin be say di marriage don take place and she be my wife.” E tok.

Police confam arrest of suspects 

Tok-tok pesin for Kano Police Command SP Abdullahi Haruna Kiyawa confam di arrest of two pipo to BBC Pidgin.

“We get complain for our Zango division about wetin happun to bride Khadija Abdullahi as some pipo use stone injure her eye as dem dey celebrate with DJ music.

“We don arrest two pipo wey go face court charges.”

Yahaya and Salisu wey Police confam say dem arrest na di two vigilante members wey storm di venue as DJ dey play music.

Meanwhile, Shehu Rabiu wey be vigilante commander for Kano state tell BBC Pidgin say e don form committee to investigate wetin happun as e be say na im members dem dey suspect for wetin happun to di bride.

Wetin some attendees of di wedding tok be say already, dem hear di vigilante members dey allegedly tok say dem go disrupt di music wey dey go on before dem storm di place.

“Di information of wetin happun to di bride don reach our side na why I form committee to investigate wetin happun and report back.”

“At di moment, I still dey wait for dia report before we take next line of action on di mata.”

DJ music and weddings for Kano

Many pipo as part of dia wedding or naming ceremony for Kano and many parts of northern Nigeria dey call DJ to play music in front of dia houses and di bride and her pipo go dey dance to di music.

E get some pipo wey dey against dis style as dem say e dey disturb neighbours wey no like music.

At di moment, e get some areas for Kano wey don ban such styles because of disturbance of peace.