You are here: HomeAfricaBBC2023 11 25Article 1887368

BBC Pidgin of Saturday, 25 November 2023

Source: BBC

How you dey abuse antibiotics wey you no know

Medicine Medicine

World Health Organisation (WHO) don draw ear give world pipo say di abuse or misuse of antibiotics dey make di medicine no dey work again and e dey cause resistant bacteria or bacteria wey dey resist medicine.

Di health join body tok dis one on Thursday afta dem release report from one investigate wey dem bin do on di use of antibiotics.

European chapter of WHO do one study wey show say pipo dey take antibiotics for tins like ordinary cold (24 percent of cases), symptoms of catarrh (16 percent), sore throat (21 percent) and cough (18 percent).

Although dis investigate wey dem do na inside 14 kontris for mostly Eastern Europe and Central Asia, different oda kontri dey suffer similar wahala.

WHO warn say if dem no do anytin sharp sharp, dis resistant bacteria go fit dey responsible for di death of 10million pipo for di world.

Wetin lead to dis warning?

Di number one health organisation for world say one of di tins wey dey be “cause for concern,” na incorrect prescription.

E say pipo dey drink antibiotics witout medical medical advice.

WHO also say e get serious gap for wetin pipo sabi about antibiotics, meaning say dem fit take am for di wrong reason and dem no go realise am.

Wetin be antibiotic?

Antibiotic na veri important medicine wey you fit use to successfully treat infections wey bacteria cause, e also fit reduce complications wey some kain serious disease fit cause.

But today, some antibiotics wey bin dey work well before to treat bacteria infections no dey work again.

Also some of dem no dey even work at all at all on some kain bacteria.

How you fit dey abuse antibiotic

E get different ways wey you fit to abuse antibiotic make e no work for you, wey you sef fit no know say you dey abuse di drug.

You fit abuse am through overuse. You dey overuse antibiotic wen dem no be di correct treatment wey you suppose dey take. Dis kain tin dey dey promote antibiotic resistance.

Antibiotic dey treat infection wey bacteria cause, but e no fit treat infection wey virus cause like cold or runny nose, catarrh, bronchitis, coughs, some ear infections, some sinus infections, stomach ache and Covid-19.

Anoda way wey you also fit abuse antibiotic witout knowing say you dey even abuse am na wen you chop am for food.

Di high demand for meat put plenty pressure on farmers and e don push dem into using different ways to take meet am, including to use antibiotics.

Pipo wey dey run animal farm dey use antibiotics plenty for dia animals.

Di animals dey consume dis antibiotics through di food wey dem dey eat and di water wey dem dey drink.

Di medicine dey serve different purpose for di animals like to prevent dem from catching disease or to make dem grow fat.

Injecting antibiotics into livestocks fit contribute to antibiotic resistance, wey mean say mean say bacteria fit adapt and become resistant to di antibiotics, Dr Taiwo Oluwatosin tell BBC News Pidgin.

Di Nigerian doctor tok say wen pipo consume meat from animals wey dem treat wit antibiotics, risk dey say dis antibiotic-resistant bacteria fit dey transmitted to humans.

“Dis poses serious health concern as e dey reduce di effectiveness of antibiotics in treating infections, and e dey make am harder to control diseases.

Di doctor tok say livestock breeders dey use antibiotics to promote growth and prevent diseases for crowded and unsanitary conditions.

“Dem dey do am to maximise production and ensure animals stay healthy for intensive farming settings. However, dis practice na major factor for di development of antibiotic-resistant bacteria, as e dey pose threat to both animal and human health,” she tok.

Doctor Oluwatoyin say individuals wey dey unknowingly consume food wey dem take antibiotics produce fit dey considered as actively engaging in antibiotics abuse.

“Di term "antibiotic abuse" typically refer to di inappropriate or excessive use of antibiotics for medical purposes.

“For di case of food, e dey more about di practices for agriculture and food production wey contribute to antibiotic resistance. Di responsibility dey more wit di producers and regulators to address dis issues for di agricultural and food industry,” di doctor tok.