You are here: HomeAfricaBBC2024 01 10Article 1910561

BBC Pidgin of Wednesday, 10 January 2024

Source: BBC

How to watch all Afcon games and facts wey you suppose sabi

African football fans | File foto African football fans | File foto

All don set for di 34th edition of African Cup of Nations wey be di biggest football tournament for Africa wia 24 teams go compete wit each oda.

Na Cote D'ivoire go host dis Afcon tournament wey go begin for 13 January 2024 and plenti pipo still dey worry as to how dem go fit watch all di games.

For di tournament, na total of 52 matches dem go play wia 36 of di games go happun for group statges bifor di knockout stage go begin for 27 January.

Surprisngly, since Afcon begin in 1957, no newcomer dey for dis year edition. Dis mean say all di participating teams wey go face diasef na familiar kontris.

Till date, Egypt still remain di king of AFCON sake of say na only dem don win di trophy seven times, even though na since 2010 dem win di trophy last.

Cameroon bin don win di Afcon trophy five times and na 2017 dem lift dia last trophy.

Di Super Eagles of Nigeria don win bronze eight times, wey mean say dem dey always reach semi-final bifor dem go crash out.

How to watch Afcon games for Nigeria?

Many Nigerians still neva sabi how dem fit watch all di games at di Afcon sake of how Multichoice bin announce say Supersport no go show di matches.

Multichoice wey be owner of Dstv wey dey house of di most popular sport channel for Nigeria announce to dia subscribers say dem no go show di Africa Cup of Nations.

Plenti pipo across Africa bin don dey hope to catch all di Afcon games for Supersport but dia hope don fade

“SuperSport no go broadcast AFCON 2023,” na wetin di statement from MultiChoice tok.

At di moment, different alternatives don dey watch di Afcon games.

Nigeria


  • NTA

Di Nigerian television Authority (NTA) on Wednesday announce say dem don sign new memorandum of understanding wit one Afro Sports wey go help dem transmit di 52 matches for di Afcon in Cote D'ivoire.

NTA na goment owned national media and na dem be di largest local TV network for NIgeria.

Wit di latest development, pipo wey get NTA channel fit enjoy all di Afcon games.

How African kontris fit watch Afcon


  • Startimes

Since Supersport no dey show di games at Afcon, Startimes don confam say dem go show all di games for di tournament.

Startimes dey Nigeria, Ghana, Kenya, Uganda, Rwanda and many oda African kontris. Dem get sports channel wey include Sports Premium, Sports Life and Beta Sports wia dem go broadcast live matches of di African Cup of Nations.


  • New World TV

CAF bin also sign a new deal wit New World Tv to make dem broadcast di Afcon game to sub-saharan Africa.

Di deal na di biggest investment wey CAF don sign so far to allow free to air and pay-TV rights across Africa. Na about $81 million wey go first last for three-year term.

Pipo wey get access to New World Tv fit watch all di Afcon games for di comfor of dia home.


  • beIN Sports

Doz wey dey northen Africa fit watch Afcon games ontop beIN Sports.

Pipo for Europe go fit watch di games ontop Sky Sports, doz for di United States go get di games ontop beIN Sports and doz for Canada go find di matches for FuboTV.

Even doz wey dey live for Asian kontris, Australia and New Zealand no go dey left behind as beIN Sports go still dey serve dem while pipo for India go fit watch ontop FanCode.

Meanwhile, some tori still dey fly say Supersports fit try renegitiate wit CAF so dem go fit broadcast di Afcon games.

Afcon 2023 schedule and kick-off times

Afta di opening match, dem go play at least two games each day during group stage wey go run until 24 January.

Di games go occur by 14:00, 17:00 and 20:00 (all times GMT) during di group stages, and di two last kick-off times dem go use am for di final round of group games and di knockout stages, wey go begin on Saturday, 27 January.

Africa Cup of Nations 2023 fixtures

Saturday 13 January

Group A: Ivory Coast vs Guinea-Bissau, Alassane Ouattara Stadium, Abidjan (20:00)

Sunday 14 January

Group A: Nigeria vs Equatorial Guinea, Alassane Ouattara Stadium, Abidjan (14:00)

Group B: Egypt vs Mozambique, Felix Houphouet-Boigny Stadium, Abidjan (17:00)

Group B: Ghana vs Cape Verde, Felix Houphouet-Boigny Stadium, Abidjan (20:00)

Monday 15 January

Group C: Senegal vs The Gambia, Charles Konan Banny Stadium, Yamoussoukro (14:00)

Group C: Cameroon vs Guinea, Yamoussoukro (17:00)

Group D: Algeria vs Angola, Stade de la Paix, Bouake (20:00)

Tuesday 16 January

Group D: Burkina Faso vs Mauritania, Bouake (14:00)

Group E: Tunisia vs Namibia, Amadou Gon Coulibaly Stadium, Korhogo (17:00)

Group E: Mali vs South Africa, Korhogo (20:00)

Wednesday 17 January

Group F: Morocco vs Tanzania, Laurent Pokou Stadium, San Pedro (17:00)

Group F: DR Congo vs Zambia, San Pedro (20:00)

Thursday 18 January

Group A: Equatorial Guinea vs Guinea-Bissau, Alassane Ouattara Stadium, Abidjan (14:00)

Group A: Ivory Coast vs Nigeria, Alassane Ouattara Stadium, Abidjan (17:00)

Group B: Egypt vs Ghana, Felix Houphouet-Boigny Stadium, Abidjan (20:00)

Friday 19 January

Group B: Cape Verde vs Mozambique, Felix Houphouet-Boigny Stadium, Abidjan (14:00)

Group C: Senegal vs Cameroon, Yamoussoukro (17:00)

Group C: Guinea vs The Gambia, Yamoussoukro (20:00)

Saturday 20 January

Group D: Algeria vs Burkina Faso, Bouake (14:00)

Group D: Mauritania vs Angola, Bouake (17:00)

Group E: Tunisia vs Mali, Korhogo (20:00)

Sunday 21 January

Group E: South Africa vs Namibia, Korhogo (20:00)

Group F: Morocco vs DR Congo, San Pedro (14:00)

Group F: Zambia vs Tanzania, San Pedro (17:00)

Monday 22 January

Group A: Equatorial Guinea vs Ivory Coast, Alassane Ouattara Stadium, Abidjan (17:00)

Group A: Guinea-Bissau vs Nigeria, Felix Houphouet-Boigny Stadium, Abidjan (17:00)

Group B: Cape Verde vs Egypt, Felix Houphouet-Boigny Stadium, Abidjan (20:00)

Group B: Mozambique vs Ghana, Alassane Ouattara Stadium, Abidjan (20:00)

Tuesday 23 January

Group C: The Gambia vs Cameroon, Bouake (17:00)

Group C: Guinea vs Senegal, Yamoussoukro (17:00)

Group D: Angola vs Burkina Faso, Yamoussoukro (20:00)

Group D: Mauritania vs Algeria, Bouake (20:00)

Wednesday 24 January

Group E: Namibia vs Mali, San Pedro (17:00)

Group E: South Africa vs Tunisia, Korhogo (17:00)

Group F: Tanzania vs DR Congo, Korhogo (20:00)

Group F: Zambia vs Morocco, San Pedro (20:00)

Africa Cup of Nations second round fixtures

Saturday 27 January

SR1: Group D Winner vs 3rd Place Group B/E/F, Bouake (17:00)

SR2: Group A Second Place vs Group C Second Place, Felix Houphouet-Boigny Stadium, Abidjan (20:00)

Sunday 28 January

SR3: Group A Winner vs 3rd Place Group C/D/E, Alassane Ouattara Stadium, Abidjan (17:00)

SR4: Group B Second Place vs Group F Second Place, San Pedro (20:00)

Monday 29 January

SR5: Group B Winner vs 3rd Place Group A/C/D, Felix Houphouet-Boigny Stadium, Abidjan (17:00)

SR6: Group C Winner vs 3rd Place Group A/B/F, Yamoussoukro (20:00)

Tuesday 30 January

SR7: Group E Winner vs Group D Second Place, Korhogo (17:00)

SR8: Group F Winner vs Group E Second Place, San Pedro (20:00)

Quarter-finals

Friday 2 February

QF1: Winner SR2 vs Winner RS1, Felix Houphouet-Boigny Stadium, Abidjan (17:00)

QF2: Winner SR4 vs Winner SR3, Alassane Ouattara Stadium, Abidjan (20:00)

Saturday 3 February

QF3: Winner SR7 vs Winner RS6, Bouake (17:00)

QF4: Winner SR5 vs Winner SR8, Yamoussoukro (20:00)

Semi-finals

Wednesday 7 February

SF1: Winner QF1 vs Winner QF4, Bouake (17:00)

SF2: Winner QF3 vs Winner QF2, Alassane Ouattara Stadium, Abidjan (20:00)

Third place play-off

Saturday 10 February

SF1 vs SF2 losers, Felix Houphouet-Boigny Stadium, Abidjan (20:00)

Final

Sunday 11 February

vs SF2 winners, Alassane Ouattara Stadium, Abidjan (20:00)