BBC Pidgin of Friday, 15 August 2025

Source: BBC

How pilot wey dey do air show crash wit plane inside water for Durban

Dem still dey find di pilot for di single manned plane Dem still dey find di pilot for di single manned plane

Police don reveal say dem still dey find popular pilot wey crash enta water near central Durban on Thursday afternoon.

According to local tori pipo, News24, dem quote di South African Civil Aviation Authority say, di aeroplane wey be ZS-AEC Extra 300 bin dey part of airshow for di North Beach. Dem bin dey perform dia final display wen e crash.

Di team from di Metro Police search and rescue team, di South African Police Service and di National Sea Rescue Institute don dey search around di beach togeda wit paramedics, fire department and oda emergency services.

News24 see search crews dey carry doti from wreckage wey include di fuselage parts and di plane wheel.

Na high tide dey affect di efforts to find di pilot bodi and oda parts of di plane. Di NSRI say di 61-year-old pilot for Johannesburg still dey miss.

Pesin wey dey di event tell News24 say, "dem pack here and school pikin gada to see di show. Di airplane bin move normal-normal for di air and evribodi dey ginger. All of a sudden, e just swing too fast but we bin reason say e dey part of di show. But wen e dey go move inside di wata, pipo start to shout and den e crash"

KwaZulu-Natal SAPS tok-tok pesin Robert Netshiunda say di pilot wey dey also fly commercial flights na di only pesin wey dey di aeroplane.

Times Live report say friends and family don dey post tributes for di pilot wey dey di accident.

Di accident wey happun for display and air show for di youth and public bin dey organised by di Civil Aviation Authority afta three day aviation global summit.

KwaZulu-Natal Transport MEC Siboniso Duma tok say di accident na unfortunate end to successful event.

E say dem don tell di family wetin happun but dem say as di mata dey sensitive dem go do proper analysis by di right time.