BBC Pidgin of Wednesday, 20 August 2025

Source: BBC

How many wars President Trump don really end?

US President Donald Trump US President Donald Trump

As President Donald Trump dey try negotiate to end di Russia-Ukraine war, im bin dey tok about im track record for peace negotiations since im start im second term for office.

Im bin tok for White House on 18 August, wen European leader put pressure on am to push for ceasefire, im claim say: "I don end six wars… all of dis deals I make am without even mentioning di word 'ceasefire'."

Di following day di number im tok rise to "seven wars".

Di Trump administration say a Nobel Peace Prize na "something wey suppose don happun " for di "peacemaker-in-chief", and dem list di "wars" im claim to end.

Some last just days - although na di result of long-standing tensions - and e no dey clear whether some of di peace deals go last.

Trump also use di word "ceasefire" plenty times wen im tok about dem for im Truth Social platform.

BBC Verify dey torchlight dis conflicts and how much credit di president go take for ending dem.

Israel and Iran

Di 12-day conflict begin wen Israel hit targets for Iran on 13 June.

Trump confam say Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu inform am ahead of di strikes.

Di US bin carry out strikes on Iranian nuclear sites - a move wey many feel say sharpely end di conflict.

On 23 June, Trump post say: "Officially, Iran go start di CEASEFIRE and, on di 12th Hour, Israel go start di CEASEFIRE and, on di 24th Hour, di world go salute Officially di END to DI 12 DAY WAR."

Afta di war end, Iran Supreme Leader Ayatollah Ali Khamenei insist say im kontri don secure a "decisive victory" and im no mention a ceasefire.

Israel dey suggest say dem fit strike Iran again to counter new threats.

"No agreement on permanent peace or on how to monitor Iran nuclear programme going forward," Michael O'Hanlon argue, im be a senior fellow for di Brookings Institution think tank.

"So wetin we get hia na more of a de facto ceasefire dan an end to war, but I go give am some credit, as di weakening of Iran by Israel - wit US help - dey strategically significant."

Pakistan and India

Tensions between dis two nuclear-armed kontris don dey for many years, but for May kasala break out sake of di attack for Indian-administered Kashmir.

Afta four days of strikes, Trump post say India and Pakistan don agree to a "FULL AND IMMEDIATE CEASEFIRE".

Im say dis na di result of "a long night of talks wey United States".

Pakistan thank Trump and later recommend am for di Nobel Peace Prize, im torchlight Trump "decisive diplomatic intervention".

India, however, play down tok of US involvement: "Di tok regarding cessation of military action happun directly between India and Pakistan under di existing channels wey dey established between both militaries," Indian Foreign Secretary Vikram Misri tok.

Rwanda and di Democratic Republic of Congo

Di long-standing wahala between dis two kontri enta anoda afta di M23 rebel group seize di mineral-rich territory for eastern DR Congo earlier in di year.

For June, di two kontris sign a peace agreement for Washington wit di aim to end decades of conflict. Trump say e gohelp increase trade between dem and US.

Di text call for "respect for di ceasefire" agreement between Rwanda and DRC for August 2024.

Since di latest deal, both sides dey accuse each oda of violating di ceasefire and di M23 rebels - wey di UK and US say get links to Rwanda - don threatened to walk away from di peace toks.

"Fight-fight still dey between Congo and Rwanda - so dat ceasefire never really hold water," na so Margaret MacMillan, one professor of history wey bin teach for di University of Oxford.

Thailand and Cambodia

On 26 July, Trump post for im Truth Social say: "I dey call di Acting Prime Minister of Thailand, right now, to request a Ceasefire, and END to di War, wey currently dey happun."

A couple of days later, di two kontris agree to an "immediate and unconditional ceasefire" after less dan a week of fighting for di border.

Malaysia bin hold di peace toks, but President Trump bin threaten to stop separate negotiations on reducing US tariffs (dat na taxes on imports) unless Thailand and Cambodia stop dia fight- fight.

Both of dem dey heavily depend on exports to US.

On 7 August, Thailand and Cambodia reach agreement wit di aim to reducing tensions along dia shared border.

Armenia and Azerbaijan

Di leaders of both kontris say Trump suppose receive di Nobel Peace Prize for im efforts to secure a peace deal, wey White House announce on 8 August.

"I think im go get good credit hia - di Oval Office signing ceremony fit don push di parties to peace," na so Oga O'Hanlon tok.

For March, di two goment bin tok say dem ready to end dia nearly 40-year conflict wey dey centred on di status of Nagorno-Karabakh.

Di most recent, serious outbreak of fight-fight na for September 2023 wen Azerbaijan bin seize di enclave (wia many ethnic Armenians dey live).

Egypt and Ethiopia

No "war" hia for di president to end, but tension don dey for long between dis two kontris sake of one dam on for River Nile.

Ethiopia Grand Ethiopian Renaissance Dam dem complete am dis summer, Egypt argue say di water e dey get from di Nile fit dey affected.

Afta 12 years of disagreement, Egypt's foreign minister tok on 29 June say tok-tok with Ethiopia don stop completly.

Trump say: "If I be Egypt, I'go want get water for di Nile." Im promise say US go resolve di issue sharp-sharp

Egypt welcome Trump words, but Ethiopian officials no too happy wit di tok.

No official deal dey ground between Egypt and Ethiopia to resolve dia differences.

Serbia and Kosovo

On 27 June, Trump claim say im prevent outbreak of war between dem, e say: "Serbia, Kosovo bin ready fight each oda, e for be big war. I tell dem if un try am, na im be say una no go do trade wit United States. Dem say, well, maybe we no go fight again."

E don tey wey dis two kontris get issue wit each oda - na legacy of di Balkan wars wey happun for 1990s – di tensions begin rise again in recent years.

"Serbia and Kosovo no dey fight or fire each oda, so dis no be war to end," Prof MacMillan tell us.

Di White House point us towards Trump diplomatic efforts for im first term.

Wia di two kontris sign economic normalisation agreements for Oval Office wit di president for 2020, but war no dey dat time.


Di 12 day conflicts hit targets for Iran and Israel



M23 rebels dey linked to Rwanda



Dis photo na August, Trump bin host di Azerbaijani president and Armenian prime minister for White House