You are here: HomeAfricaBBC2023 12 07Article 1894589

BBC Pidgin of Thursday, 7 December 2023

Source: BBC

How grave looters invade Takoradi cemetery for Ghana

File foto File foto

Residents for Takoradi wey dey di Western region of Ghana don dey worry about di way grave looters don invade di cemetery.

Di cemetery wey don close down in 2018 because im make full, now get plenty graves wey don scatter.

Pipo don tiff some of di tiles, metal works, marbles and oda ornaments wey dem take mould tombstones for dia.

Workers for di cemetery say dem discover di mata a month ago wia dem raise alarm.

“Dis na serious mata, plenti of di graves don dey affected wia some of di caskets dey outside,” one worker tok.

Anoda pesin tok say “dis na di first time I dey witness say pipo dey tiff tins for cemetery.”

Afta di news don comot for town say dis be wetin happun, some pipo rush to do place to check if di graves of dia family don dey safe.

One of dem na Maame.

“I come check di place, but l don make lucky. My papa im grave dey safe,” im tok.

Maame add say im broda im pickin “dia grave also no dey affected.”

But im want make authorities deal wit di mata fast.

Oda pipo for di area don dey fire di Sekondi-Takoradi metropolitan assembly ova di mata.

Nana vex di assembly because na dem dey collect moni for pipo before dem allow dem to bury dia dead for di cemetery.

“If one or two graves wey dey affected, no wahala dey, but dis one na plenti tombs, so di assembly get questions to answer,” Nana explain.

Anoda pesin tok say di looters don dey take advantage of di darkness for di cemetery area at night.

Wetin Sekondi-Takoradi Metropolitan assembly dey do about di mata

For 2018, one pesin don chop arrest afta im tiff metal signposts and oda metals from some of di graves for der at night.

Di assembly take am go court.

But di court caution di suspect wia dem discharge am.

Dis mata vex authorities for di sekondi-takoradi metropolitan assembly (STMA) well well.

Oga wey be environmental sabi pesin for di STMA, Abdul Karim Wudu tok say dat tin di court do be one of di reason pipo go continue to loot for di cemetery.

“We no go fit sacrifice den arrest pesin wey dey tiff for here and di court go discharge am. E dey pain.”

But as dis fresh mass invasion happun, di STMA say dem go take some drastic action.

Abdul Karim Wudu say di assembly “go hire more security pipo make dem dey watch di place.”

Im also add say dem go fix street light for di whole area.

“Di assembly dey also consider say we go fix levy for families wey get dia relatives for di cemetery so we go use di moni maintain di place.”

Di oga for di STMA also warn say im no go dey responsible if di security pipo catch pesin for di cemetry at night.