BBC Pidgin of Tuesday, 28 January 2025
Source: BBC
Shock, disbelief, sadness, relief, na how some fans, celebrities and concerned pesins take react afta Nigeria famous music icon, Innocent Idibia announce separation from im wife, Annie Idibia.
On Sunday, 26 January, di music star wey pipo sabi well-well as Tuface reveal say im and im wife of ova 10 years don separate for sometimes now and dem dey wait for divorce.
E announce di informate for inside one post e share on im Instagram account.
"Well dis thing wey I wan tok dey short but also long. I and Annie Macaulay don separate for a while now. And currently filed divorce."
For di post, di 49-year-old singer promise to release a statement soon to share im side of di tori. E add say while im personal life dey private, e feel say e dey necessary to provide clarity out of love for im supporters.
"Hello to my beautiful pipo of all federations. Well, dis thing I wan tok dey short but also long. Annie Macaulay and I don dey separated for a while and don file for divorce.
"I go grant press release soon to say my story—no be becos na anyone right to know about my personal life, but becos I love my pipo, and I need dem to know my innocence or offence. Stay blessed, my pipo. I love you all," di singer add for di now deleted post.
Drama afta viral separation post
Di post wey announce di separation and probably divorce of these love birds wey dia grand wedding for 2013 shake di kontri, bin shock some of dia fans, while odas say, di separation dey long overdue.
However, within minutes afta di post go viral, Tuface for anoda post on im Instagram page claim say im account dey hacked and dem dey try to get am back.
"My Instagram don dey hacked; wey dey put effort to try take back control. #One Love."
As fans dey rejoice and deliberate on di authenticity of di post, Tuface for anoda video, almost immediately post again for im Instagram account say nobody hack im account.
"Hey, my pipo nobody hack my account; I tok wetin I tok. I come in peace."
As at Monday, 27 January morning, BBC Pidgin check say e don delete most of di post on im Instagram account, wey include fotos of im and im wife.