You are here: HomeAfricaBBC2024 01 06Article 1908500

BBC Pidgin of Saturday, 6 January 2024

Source: BBC

How dog enjoy di most expensive meal of im life - wey be $4,000 cash

Dis na di moni wey Cecil chop - wey worth $4000 cash Dis na di moni wey Cecil chop - wey worth $4000 cash

One Pittsburgh couple dog don land for trouble afta e chop $4,000 (£3,153) cash wey im owners put for house.

Cecil, one Goldendoodle from Pennsylvania, don go viral sake of say e chop di envelope of money im owners bin keep for contractor.

Clayton and Carrie Law bin put togeda most of di moni wey don tear-tear into pieces - dem still dey find $450.

Cecil veterinarian tell di couple say dia greedy pet go dey OK.

For early December, Clayton Law bin put di envelope wey contain $4,000 on im kitchen counter for im house for Pittsburgh, Pennsylvania. E and im wife, Carrie, wan use di money pay dia contractor in cash for installing fence.

About 30 minutes later, to im surprise, e see im beloved dog dey enjoy di priciest meal of im life, leaving rough strips and scattered pieces of cash evriwia.

"Suddenly Clayton shout to me, 'Cecil dey chop $4,000!'" Carrie Law tok for one interview wit di Pittsburgh City Paper. "I bin tink say I no dey hear wetin e tok '. I bin almost get heart attack."

Di Laws bin describe Cecil as "a goofy guy" wen dem follow Washington Post tok.

"E dey very particular - you fit leave meat on top table, and e no go touch am becos e no dey food motivated," Carrie Law tell di paper. "But apparently e dey moni motivated."

While Cecil run go sleep for chair afta e chop di moni finish, di couple immediately call Cecil veterinarian to see if e go need any medical treatment. Luckily, because Cecil na big dog, di veterinarian tok say dem go only need to monitor am for house.

Di couple come resume work dey try gum di moni togeda.

Before dem even begin gum di moni togeda, however, dem gatz wait for Cecil to vomit di cash. Afta dat, dem scrub di bills well-well.

Carrie tell City Paper say as dem dey try wash di bill. "E smell so bad."

Di couple come try to tape together di destroyed $50 and $100 bills bit by bit. Dem bin work to locate di serial numbers on both sides of di bills to make sure say banks go accept and replace dem wit fresh notes.

Di bank bin collect most of di moni – but dem no fit recover $450 - and dem tell di Laws say dis kain incidents dey common.

One similar situation bin occur for 2022, Newsweek bin report, wen one Florida woman Labrador chop $2,000 (£1,576) cash.

Video of di incident, wey make di dog momentary internet star, show as di pet owner dey cry.

Di Laws, meanwhile, tok say dem dey try see di joke for di situation, dem write on dia viral video say "di remaining scraps go be our most expensive piece of art".