You are here: HomeAfricaBBC2023 01 17Article 1696952

BBC Pidgin of Tuesday, 17 January 2023

Source: BBC

How dem bury Lagos lawyer wey policeman allegedly kill on Christmas day

The late Omobolanle Raheem The late Omobolanle Raheem

Di burial of slain Lagos based lawyer Omobolanle Raheem wey police man allegedly shoot and kill hold today for Lagos, as friends, family members, colleagues and sympathizers come out to say dia final goodbye.

Di funeral service hold for di for di Olive Tree branch of di Redeemed Christian Church of God RCCG Ikoyi. Pipo read tributes to her for di event.

Her husband and her only child wey be girl attend di funeral service.

Mourners wear black attire attend di ceremony. Pipo dey cry, dey shed tears and show emotions as di funeral service dey happun.

After di service dem move her body to Vault and Gardens cemetery Ibeju Lekki wia dem bury her.

Di interment ceremony na private event wey dem no allow journalists cover.

Na only her family, church members and few friends go near di grace side as dem laid down her coffin.

Wetin lead to di death of Bolanle

Police man on road duty allegedly shoot and kill 41 years old Bolanle for Ajah area of Lagos state on Christmas Day 2022.

One of di police men on duty dat date tell court on Monday say dem stop di car wey she dey inside but di car no stop and im colleague Vandi fire im gun wey allegedly kill di lawyer.

Authorities arrest di accused police officer and im dey face murder charge before di Justice Ibironke Harrison court for Lagos state Hight Court.

Di officer plead not guilty to di offense wen im trial start on Monday.

Wen tori of di death of Bolanle enter di airwaves during di Christmas period, plenti pipo condemn di killing including goment officials, politicians and even di president of Nigeria write statement about her death.

Govnor of Lagos state Babajide Sanwo-Olu promise to ensure say di deceased get justice.

Who be Bolanle Raheem?

Who be Bolanle Raheem? Bolanle Raheem na lawyer, di chief executive officer and lead consultant of Croston Homes Consulting wey dey Lagos, southwest Nigeria.

She be member of di Lagos branch of di Nigerian Bar Association (NBA) and na mother of one pikin.

Bolanle na graduate of Olabisi Onabanjo University, Ago Iwoye, Ogun State.

Di entreprenuer na award-winning realtor wey also dey coach pipo on her line of business