You are here: HomeAfricaBBC2023 06 14Article 1786151

BBC Pidgin of Wednesday, 14 June 2023

Source: BBC

How boat accident kill around 150 pipo for Kwara state

Boat accidents common for Africa - File photo Boat accidents common for Africa - File photo

Authorities for Kwara state don confam di death of 150 pipo for one boat accident wey happun early mor-mor on Monday for Pategi local goment area.

Di boat wey bin carry 300 passengers bin dey return from one wedding bin dey travel for night wen e capsize around 3am due to engine fault.

Tori be say di incident happun for Egbu village, Patigi local government of Kwara state – to pipo wey return from Egboti village for Niger State.

Di Emir or Etsu of Patigi Emirate Council, His Royal Highness Alhaji Ibrahim Umar Bologi, wey confam di incident say, dem don rescue 53 pipo alive, 150 dey confam dead and more dan 90 pipo still dey miss.

Oga Bologi say rescue workers still dey dey search for di pipo wey dey miss.

“Di local pipo for di community dey do dia best currently to see how to recover di oda deadi body dem wey remain for di water, “ di Emir tok.

Problem of overloading & no life jackets

Oga Bologi attribute di accident to di problem of overloading, as e say most owners no sabi di capacity of dia boat.

Anoda wahala wey lead to so many death according to di traditional ruler na di lack of life jackets.

E say although dem get some live jackes, e no dey enof to go round di many pasengers wey dey travel by water, especially as Pategi dey surrounded by water.

Di boat accident affect pipo from many different communities including Ebu, Dzakan, Kpada, Kuchalu and Sampi – all for inside di Pategi local goment.

Cases of boat accidents for Nigeria

Nigeria no be stranger to boat accidents at all.

Di kontri na one African kontri wey dey face boat accidents plenty sake of overloading.

For October 2022 10 pipo die afta one jetty wey suppose carry 48 pipo but carry 85 instead, for Onitsha, Anambra state.

Kano state for North of di kontri face tragedy for Bagwai river wen 29 pipo die for afta boat capsize due to overload.