You are here: HomeAfricaBBC2022 10 26Article 1650968

BBC Pidgin of Wednesday, 26 October 2022

Source: BBC

How Russia first nuclear drill since invasion of Ukraine war take happun

Russian President Vladimir Putin Russian President Vladimir Putin

Vladimir Putin don supervise di annual exercise by Russia strategic nuclear forces wey dey see di kontri do missile testing. Dis one dey come as tensions wit di West dey high sake of di eight-month-long war for Ukraine. Dem lunch Ballistic and cruise missiles from di Arctic to Russia Far East, Kremlin tok. Tori be say dem bin inform US about di drill under di terms of agreement wey be di New Start arms treaty. Di launch take place as Russia dey claim say Ukraine dey plot to use one "dirty bomb". "Dirty bomb" na explosive device wey dem mix wit radioactive material but di Western kontries don reject Russia allegations say no be true. Kyiv bin warn say dis claims mean say Moscow fit dey prepare for dat kain attack. Di last Russian nuclear drill bin take place five days before dem bin invade Ukraine. Ahead of di latest exercise, military officials for Washington point out say, dis one way dem notify US, e mean say Russians dey comply wit arms control obligations. Nato dey also stage dia own nuclear exercises, wey dem call Steadfast Noon, for north-western Europe. Di Western defensive alliance say training flights wey involve 14 kontris dey take place until Sunday ova Belgium, UK and di North Sea. Russia exercises bin take place just as one flagging campaign dey happun for southern and eastern Ukraine. Moscow bin send sojas to key southern city of Kherson to help defend dia. Russia bin take Kherson for di early days of di war, but recently dey bin come under pressure as Ukrainian sojas begin dey advance. Defence Minister Sergei Shoigu appear for Russian TV, e say di plan of di drill na for di military command and control to practise how to carry out "a massive nuclear strike by di strategic nuclear forces to revenge di enemy nuclear strike".  Na Yars inter-continental ballistic missile dem launch from Plesetsk cosmodrome, some 800km (500 miles) north of Moscow, and Sineva ballistic missile dem fire from di Barents Sea to di remote Kura test site for Kamchatka province for Russia Far East, Kremlin tok. All di missiles bin reach dia targets, dem tok. Russian TV show President Putin as im dey watch video feed of di launch. Broadcast footage of di remarks e give via videolink to one conference of regional intelligence services wia im agin im bin dey accuse Ukraine of di dirty bomb plot. E also repeat di oda allegations wey Russia bin make some months against Ukraine, including di one e say US don test dem into a "testing ground for military biological experiments". Ukraine Defence Minister Oleksiy Reznikov tok on Wednesday say "my personal opinion be say Putin no go use nukes". For anoda interview, e tell US TV say Ukraine counter-offensive for south dey affected by rainy weather. For one an address to di nation wey im do for September, Oga Putin say im kontri get "various weapons of destruction" and dem go "use all di means available to us", e add say: "I no dey joke." Afta dat tok, EU foreign policy chief, Josep Borrell, tell BBC say "dis na dangerous moment [for di war] because dem don push di Russian army go corner, and Putin reaction - threatening using nuclear arms - dey very bad".