You are here: HomeAfricaBBC2023 11 09Article 1877972

BBC Pidgin of Thursday, 9 November 2023

Source: BBC

How Robot kill man wey dey test im sensor for South Korea

Some robots at work Some robots at work

One man die for South Korea sake of robot wey no fit differentiate am from di boxes of food wey im bin dey carry, according to tori.

Di incident happun wen di man, wey dey work for one robotics company wey dey around 40 years dey inspect di robot.

Di robot hand, tink say di man na box of vegetables, na im im grab am, den push im body inside di conveyer belt.

Di conveyor belt crush di face and chest of di man, according to South Korean news agency Yonhap.

Dem rush am go hospital but im no survive.

According to Yonhap, di robot work na to lift boxes of peppers and transfer dem onto pallets.

Di man bin dey check di robot sensor operations ahead of di test run for di pepper sorting plant in South Gyeongsang province, on 8 November, di agency add, as dem quote police.

Dem bin originally plan di test run for 6 November, but dem push am back by two days sake of problems wit di robot sensor.

Di man, wey dey work for di company wey manufacture di robotic arm, bin dey run checks on di machine late into di night on Wednesday wen e malfunction.

For statement afta di incident, one official from di Donggoseong Export Agricultural Complex, wey get di plant, tok say make dem establish "precise and safe" system.

For March, one South Korean man wey bin dey in im 50s suffer serious injuries afta one robot trap am wen im bin dey work for one automobile parts manufacturing plant.