You are here: HomeAfricaBBC2023 07 17Article 1806383

BBC Pidgin of Monday, 17 July 2023

Source: BBC

How Alcaraz end Djokovic dominance to win Wimbledon

Carlos Alcaraz don win di Wimbledon men singles title for di first time Carlos Alcaraz don win di Wimbledon men singles title for di first time

Carlos Alcaraz don win di Wimbledon men singles title for di first time by ending Novak Djokovic's recent dominance with one ogbonge victory.

Spain Alcaraz, 20, fight back from a nervy start to win 1-6 7-6 (8-6) 6-1 3-6 6-4 against di defending champion.

Djokovic bin dey go for a fifth straight win, an eighth men triumph and a 24th major - all record-equalling feats.

But di 36-year-old Serb dey outlasted by top seed Alcaraz, wey underline im class by winning a second major title.

"Na dream come true for me," Alcaraz, who bin dey play for only im fourth grass-court tournament, tok.

"Even if I loss, I for still dey proud of myself. To be able to play for dis stages of these occasions - as one boy of 20 years old - dey really fast.

"I dey really proud of myself."

Alcaraz, wey win im first Grand Slam title fro di US Open last year, celebrate by falling flat on im face after taking im first match point and kicking a ball into di crowd.